Wetin we know about 21-year-old man wey dem kpai afta e enta secure perimeter of Trump Mar-a-Lago residence

Wia dis foto come from, Scott Olson/Getty Images
Di US Secret Service say dem don shoot and kpai one man wey dem identify as Austin T Martin afta e enta inside di secure perimeter of Trump Mar-a-Lago residence.
Officers say Martin bin carry shotgun and fuel can wen dem stop am for one of di gates for Mar-a-Lago.
Di incident happun about 01:30 ET (06:30 GMT).
Officials say di FBI dey assist wit di investigation and dey collect evidence.
Di US president bin no dey for Florida during di incident, officials tok.
Martin come from Cameron, North Carolina, multiple sources tell di BBC US partner CBS News.
Agents and one deputy from di Palm Beach County Sheriff Office bin confront di man, wey bin enta di inner perimeter at 01:30 local time (06:30 GMT).
Sheriff Ric Bradshaw tell journalists say security find Martin wey carry petrol canister and shotgun.
Dem order Martin to drop dem. E drop di can and raise di shotgun to a firing position. At dat point, agents fire dia weapons to "neutralise di threat", Bradshaw tok.
Di officers bin dey wear bodi cameras. Two agencies bin dey involved - di Secret Service and di Sheriff Office. No law enforcement officers sustain injury.
Martin family bin report am missing just yesterday, CBS report.
Officials dey look into weda e buy di gun along di driving route e bin take from North Carolina to Florida, according to CBS.
No be di first time officers don deal wit armed suspects while protecting Trump
Dis no be di first time officers don deal wit armed suspects while protecting Donald Trump.
For September 2024, one US Secret Service agent bin see rifle dey comot di bush for Trump International Golf Club for West Palm Beach. Dem later catch di man, Ryan Routh even though e bin run.
Routh bin later dey found guilty say e bin try to assassinate Trump, and for February 2026 dem sentence am to life in prison.
For July 2024, one man shoot at Trump for campaign rally for Butler, Pennsylvania. Dem kpai di 20-year-old attacker Thomas Matthew Crooks for di attack. One oda pesin die and two bin dey seriously injured as dem shoot Trump sef, for ear.
Treasury Secretary Scott Bessent tell Fox News say im don tok wit President Trump.
Bessent say Trump and im family dey safe, but add: "Dem no suppose dey endure attempt afta attempt."
E say di security perimeter around di president dey as strong as eva, and di Secret Service dey much beta now dan dem bin dey at di time of di assassination attempt for Butler, Pennsylvania for 2024.
Bessent also blame political violence like dis on di left.
"Dis existential threat, dis venom from di left really gatz stop. Dem don normalise dis violence," e tok.










