World leaders react, Trump dey safe afta assassination attempt

Wia dis foto come from, Getty Images
World leaders don sharply condemn di Saturday assassination attempt on former US President Donald Trump, as dem express shock, denounce political violence plus wish am quick recovery.
Di attack wia dem shot Trump for ear occur for one presidential campaign wey im bin dey do for Pennsylvania.
British Prime Minister Keir Starmer say im dey "irritated by di shocking scenes" for di rally. Come add say: "Political violence in any form no get place for our societies and my mind dey wit all di victims of dis attack."
One tok tok pesin for United Nations Secretary-General Antonio Guterres, condemn di shooting wey im call "act of political violence."
Japan Prime Minister Fumio Kishida, say: "We must stand firm against any form of violence wey challenge democracy."
Ukraine President Volodymyr Zelenskiy say "no justification" dey for dis kain violence and say im dey "relieved" say Trump, wey bin dey always criticise U.S. military aid to Ukraine as Russia dey invade di kontri, dey safe, come wish am "speedy recovery."
Australia Prime Minister Anthony Albanese say wetin happun to di former president dey “concerning and confronting.”
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
"Dis na tragedy for our democracies," French President Emmanuel Macron tok about di shooting. "France dey follow share di shock and anger of di American pipo."
Canadian Prime Minister Justin Trudeau say im dey "sickened" by wetin happun to Trump, come add say: "Political violence no ever dey acceptable."
Leaders from European Union, Egypt, Thailand, Taiwan, South Korea, New Zealand, Italy, Sweden, di Netherlands and di Philippines, all tok similar tin.
Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu also say di attack shock am.
Hungary Prime Minister Viktor Orban, wey bin meet Trump dis week during im visit to U.S. for NATO summit, say im prayers dey wit di former president “for dis dark hours.”
Brazil President Luiz Inacio Lula da Silva call di shooting “unacceptable.”
While India Prime Minister Narendra Modi call Trump im friend as im condemn wetin happun.
“Di attack on former President Donald Trump dey bad and e no follow democratic norms," Nigeria President Bola Tinubu tok.
"Nigeria stand in solidarity wit di United States of America at dis time," e add, as e extend im sympathy give di former presido and also tok sorry to di family of pesin wey die from di shooting and wish those wey injure quick recovery.

Wia dis foto come from, Narendra Modi/X
Trump dey safe, attacker don die

Wia dis foto come from, Reuters
Di suspect for di incident for Donald Trump rally don die, along with one audience member, local district attorney Richard Goldinger don tell di Associated Press and local media.
CBS, BBC news partner for US, also report say na secret service agents "engage" di suspect. Two law enforcement sources tell CBS di male suspect don die.
Secret Service agents bin rush former President Trump comot from stage afta loud noise sound for one rally for Pennsylvania.
Video show as Trump quickly hide as sharp cracks – wey be sound of gun - break out.
Secret service agents shaparly cover am den rush am comot for stage, carry am enta motor.
Trump campaign for statement say e dey "fine" and dem dey check am put for one local medical facility.
“President Trump thank law enforcement and first responders for dia quick action during dis terrible act,” tok-tok pesin Steven Cheung tok.
Video show say blood dey di right ear of Donald Trump – but e still raise im hand as di Secret service dey carry am comot for stage go enta motor.
Police pipo wey carry gun quickly take over di stage afta di incident.
Di Secret Service for statement say Trump dey safe and say dem bin implement measures for im protection.
Dem add say active investigation don start on top di mata and say dem go release more informate wen e dey available.
Di Republican candidate for president bin dey address im supporters for Butler, Pennsylvania – wey be important swing state ahead of di November election.
Pipo begin ginger as Trump attack im successor, President Joe Biden, and im administration.
Plenty supporters wey carry placards wey bin dey stand behind Trump also hide as dem hear di sound of gun.
One witness, Jason, tell BBC say e bin hear like five shots, wey dey sharp.
“We see di Secret Service jump on Trump to protect am. Evribody for dia quickly lie down," e tok.
“E den stand up and raise im hand and still tok some tins”.
Tim – wey also dey di rally - tell BBC say im hear plenty gun shots.
"Dem bin spray sometin wey we tink say na fire hose, and den di speaker on di right hand side start to come down, "e tok.
"Something must to don hit di hydraulic lines [wey make am fall]. We see President Trump bend down evribody too go down sake of di kata-kata, chaos."
Politicians of both parties don condemn di attack.
Pennsylvania Governor Josh Shapiro, wey be Democrat, say "violence targeted for any political party or political leader dey absolutely unacceptable".
Former Vice-President Mike Pence say im and im wife dey pray for Trump, adding say e urge "evri American to join us".
House Minority Leader Hakeem Jeffries for statement say: “My thoughts and prayers dey wit former President Trump. I dey thankful for di decisive law enforcement response. America na democracy. Political violence of any kind no dey acceptable.”
BBC US news partner, CBS, quote two law enforcement sources wey say di attacker bin dey armed with a rifle and stand outside di cordoned-off area for di rally, about 200 yards from Trump.
Di officials say di suspect bin stand on an "elevated structure".
Na member of di US Secret Service counter-assault team kill am, CBS report.
Oda times for US history wey leaders die or survive assassination
Di last time wey attempt to assassinate US president or presidential candidate bin happun na for 1981 wen John Hinkley shoot Ronald Reagan.
Dis dramatic act of violence against Trump na reminder of di darker times for US history, more dan 50 years ago.
For history of di kontri, four U.S. presidents na im dem don assassinate while dem still dey serve for ffice.
Abraham Lincoln: John Wilkes Booth kill am for 1865 for Ford Theatre for Washington.
James Garfield: Dem shoot am for for one Washington train station for 1881, and im die from im wounds two and a half months later.
William McKinley: One anarchist for Buffalo, New York, assassinate am for 1901.
John F. Kennedy: Lee Harvey Oswald shoot Kennedy for 1963 for Dallas, Texas as di president bin dey ride for motorcade.
Leaders wey survive assassination attempt
Three US presidents bin don wound but survive assassination attempts, while dem bin still dey office or afta dem don live office.
Donald Trump: Trump na di most recent one wey don survive assassination attempt.
Ronald Reagan: Dem shoot am for 1981 outside Hilton Hotel for Washington but im survive di attack.
Reagan wound wen one of di bullets wey hit one of di limousines, bounce back come hit am under im left armpit.
President Gerald Ford: Survive two assassination attempts on im life in less dan three weeks for 1975 without injury.
Theodore Roosevelt: Dem shoot am for chest for 1912 as im bin dey campaign for elections for Milwaukee and im survive.
Oda leaders wey dem attempt to assassinate
Robert F. Kennedy: Na U.S. presidential candidate wey dem assassinate for 1968 at age of 42 for Ambassador Hotel, Los Angeles.
Alabama Governor George C. Wallace: Dem shoot am for 1982 and im become paralyze from waist down.
Civil rights leaders like Medgar Evers, Martin Luther King Jr and Malcolm X also die for political violence.
Like today, di 1960s bin dey full of heavy political division and dysfunction, wen gun plus pesin wey dey willing to use am fit change history.
Wetin we sabi so far about di shooting

Wia dis foto come from, Getty Images
Donald Trump bin injure after one gunman open fire during campaign rally for Pennsylvania. Dis na a summary of everything we know so far:
- Dem rush di former president from stage after wetin FBI is now dey call an assassination attempt.
- Video show as e squeeze face and raise im hand to im right ear, before e take cover as several sharp cracks - several shots - ring out
- Inside post to im Truth Social network, Trump say one bullet pierce di "upper part" of im right ear and e thank di Secret Service.
- E comot hospital shortly after receiving treatment
- Secret Service agents don shoot di gunman dead.
- Di shooting also kill one bystander and injure two others. Authorities say all three victims be adult males
- President Joe Biden don strongly condemn di "sick" attack, adding, say "There's no place in America for dis kind of violence". E don also speak to Trump
- Na about five minutes into im campaign speech for one rally for Butler, Pennsylvania, loud bangs ring out as former President Donald Trump bin dey speak.
- Di crowd shout “dodge” as di shots ring out
- Secret Service rush di former president for several seconds before dem rush am comot stage with blood near im ear and on di side of im face.
- E pump im fist in di air as dem escort am down di stairs of di stage and toward one SUV.
More fotos from di shooting

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images


Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images










