Di new military service plan Germany wan use to boost troop numbers

Wia dis foto come from, EPA
- Author, Jessica Parker
- Role, Berlin correspondent
- Read am in 5 mins
Germany coalition govment don agree one new military service plan wey go boost troop numbers sake of months of fight between political forces.
Di new military service plan go mandate all 18-year-old men to fill out questionnaire weda dem dey suitable to serve and, from 2027, dem go do medical screening.
Di decision dey come as Berlin dey aim to create di strongest conventional army for Europe.
Di oga of Germany biggest defence firm, Rheinmetall, tell BBC say im believe say dem fit meet di target in five years.
Lawmakers dey expected to vote on di plan by di end of 2025.
Armin Papperger say Chancellor Friedrich Merz aim to boost di Bundeswehr dey "realistic" and im tell di BBC say "clear decisions" dey come from govment.
Earlier dis year, German defence chief Gen Carsten Breuer bin warn say di Western Nato alliance bin need to prepare for possible Russian attack within four years.
Mr Papperger say im bin "no get glass ball" about di future but agree say Germany need to dey "ready in '29".
Wen dem bin form di coalition earlier dis year, Merz conservative CDU/CSU and di centre-left Social Democrat SPD bin agree to re-introduce military service wey go dey voluntary "to start wit".
Di Bundeswehr currently get around 182,000 troops. Di new military service model dey aim to increase di number by 20,000 ova di next year, wey go rise to between 255,000 and 260,000 ova di next 10 years, supplemented by approximately 200,000 reservists.
From next year, dem go send all 18-year-old men and women one questionnaire to assess dia interest and willingness to join di armed forces. E go dey mandatory for men and voluntary for women.
From July 2027, all men wey dey 18 go also do medical exam to assess dia fitness for duty.
If di govment no meet dia target, dem go try one form of compulsory enlistment wey parliament fit consider. If war wan hapun now, di military go fit look di questionnaires and medical exams for potential recruits.
Some wey dey within Germany political left still no support di mandatory service at all.
Small fear dey say many young Germans no too feel am and a significant majority no support am. One recent Forsa survey for Stern magazine bin suggest say while just ova half of respondents favour di compulsory service, opposition bin rise to 63% among 18- to 29-year-olds.
"I no wan go war becos I no want to die or I no want make dem shoot me" Na wetin Jimi, wey be 17-years old student from Berlin, wey bin attend one anti-conscription protest outside di Bundestag earlier dis week tok. "I no wan shoot pipo."
Attack against Germany na "unlikely and abstract scenario" wey di govment bin use to legalise "stealing millions of young pipo right to decide wetin dem wan do", im tok.
Meanwhile, 21-year-old Jason bin sign up as new Bundeswehr recruit early dis year becos of di current "security situation".
"I bin wan contribute to defend peace, to defend democracy if di worst hapun," im tok. As im join, e say im bin feel like "giving back to society" but also believe in di army, "so potential enemies no dey even tink about attacking you".

Defence Minister Boris Pistorius bin want to reassure Germans, say despite di new military service plan no " cause for concern... no reason for fear".
"Di more capable of deterrence and defence our armed forces dey, through armament through training and through personnel, di less likely say e go be say we go become a party to di conflict at all," Pistorius tok.
Defence spending for Germany tumble afta di end of di Cold War, while dem bin suspend compulsory recruitment for 2011.
Sake of dia past, Germany no dey too show dia military might since, but early dis year, Friedrich Merz bin announce say di rule for German defence "now go be whatever it takes", sake of Russia full-scale invasion of Ukraine.
Nato kontris across Europe don come under pressure from President Donald Trump White House to hike spending.
Di move wey Europe dey make to re-arm don mean significant revenue for Rheinmetall.
Di CEO, Armin Papperger, wey im company dey also supply Ukraine, say: "We dey make plenti money becos di demand big well-well."
"We need to grow strong on vehicles, on ammunition, we need to get our own satellite competencies. We dey do much more on di electronics and artificial intelligence... dan ever bifor," im tok.
One US report last year bin suggest say di Rheinmetall boss na di target of one Russian assassination plot. Confirmation bin no dey dat time and Mr Papperger no gree tok on di report, but im say: "I feel good, I feel safe."
On weda im feel say Europe bin dey in a state of a cold or hybrid war, im say: "Anytin wey you call am, no be peaceful time."









