Twelve pipo injure afta man attack dem wit knife for German city of Hamburg

Police in Germany

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 3 mins

Twelve pipo don injure for one knife attack for di main railway station for di German city of Hamburg, local media report.

Local media reports say three of di victims dey for critical condition and three odas seriously dey injured.

Police say dem don gbab one suspect and a major operation dey under way.

Di attack happun for Hamburg Central Station around 18:00 local time (17:00 BST) on Friday 23 May.

One tok-tok pesin for di Hamburg fire department tell AFP news agency say 12 pipo injure and say some of di injuries dey life-threatening.

For one post on X, Hamburg Police say: "According to initial findings, one pesin allegedly injure several pipo wit a knife for di main station.

"Police gbab di suspect."

Local media report say di attack happun near platforms 13 and 14 - wey dey accessible via one busy main road - while one train bin dey on one of di platforms.

Dem treat some of di victims inside trains, local media report.

Pictures from di scene show some emergency service personnel and vehicles on di ground, and barriers wey bin hide di pipo wey injure from public view.

One foto wey local media sites use show paramedics dey take one man away on stretcher.

Police in Hamburg

Wia dis foto come from, Reuters

One video on social media show officers dey escort di suspect out of di station platform wit her hands behind her back and dem put am inside police vehicle.

Hamburg Central Station na one of Germany busiest transport hubs, wit more dan 550,000 travellers per day, according to dia website. Pipo dey always full dia during Friday rush hour.

Dis na di latest violent attack for Germany in recent months.

For December 2024, five pipo wey include one pikin die and ova 200 odas injure afta one car drive enta one Christmas market for eastern German city of Magdeburg wia crowd full, officials tok.

German media bin report say di number of pipo wey die rise from two.

For inside one statement, authorities say 68 pipo injure, and 15 pipo injury dey serious.

Reiner Haseloff, di premier of Saxony-Anhalt state, tell tori pipo for di scene of di incident say di suspect – wey dem arrest – na one 50-year-old Saudi citizen wey land Germany for 2006 and wey don work as a doctor.