German Christmas market attack death toll rise to 5 as ova 200 injure

Wetin we call dis Video, Video shows arrest of Magdeburg attack suspect
    • Author, Jake Lapham
    • Role, BBC News
    • Author, Aleks Phillips
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

Five pipo wey include one pikin die and ova 200 odas injure afta one car drive enta one Christmas market for eastern German city of Magdeburg wia crowd full, officials tok.

German media bin report on Saturday say di number of pipo wey die don rise from two.

For inside one statement on Friday, authorities say 68 pipo injure, and 15 pipo injury dey serious.

Reiner Haseloff, di premier of Saxony-Anhalt state, tell tori pipo for di scene of di incident say di suspect – wey dem arrest – na one 50-year-old Saudi citizen wey land Germany for 2006 and wey don work as a doctor.

E say preliminary investigation suggest say di alleged attacker dey act alone. E say im no fit rule out further deaths sake of di number of pipo wey injure.

Police and ambulances stand next to di Christmas market in Magdeburg

Wia dis foto come from, Getty Images

Di motive of di suspected attacker neva dey clear, and e no get any known links to Islamist extremism. Im posts on social media and online appear to suggest say e dey critical of Islam.

Footage from di scene show plenty emergency services vehicles dey attend to pipo wey lie down for ground.

Further footage show as armed police dey confront and arrest one man wey lie down for ground near one stationary vehicle.

Unverified video on social media show as one car drive speed enta di crowd for di market.

City officials tok say around 100 police, medics and firefighters, plus 50 rescue service personnel bin rush go di scene.

German Chancellor Olaf Scholz say: "My thoughts dey wit di victims and dia loved ones. We stand by dia side and by di side of all Magdeburg residents. My thanks to all di emergency services for dis difficult hours."

Scholz go visit di city on Saturday, Haseloff tok, and memorial service go hold for di victims for di Magdeburg Cathedral.

Firefighters and emergency responders set up triage units near di Christmas market in Magdeburg

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Officials say around 100 firefighters and 50 rescue workers dey for di scene of di incident

Who be di victims?

Authorities confam say one nine-year-old boy and four women die for di attack.

More dan 200 pipo and at least 41 of dem dey for critical condition.

Police for Magdeburg neva identify di victims yet, but on late on Saturday dem say dem dey between 45, 52, 67 and 75.

Who be di suspect?

German media don identify di suspect as Taleb al-Abdulmohsen.

E be 50-year-old Saudi-born psychiatrist wey dey live for Bernburg, around 40km (25 miles from Magdeburg miles) south of Magdeburg.

E don dey custody on suspicion of five counts of murder, multiple attempted murders and dangerous bodily harm, police tok.

Di motive behind di attack neva dey clear but authorities tok say dem believe say e carry out di attack alone.

Al-Abdulmohsen land Germany for 2006 and for 2016 e dey recognised as refugee.

Germany Interior Minister Nancy Faeser tell tori pipo say e dey "clear to see" say di suspect hold "Islamophobic" views.

E bin run one website wey bin aim to help oda former Muslims run from persecution for dia Gulf homelands.

Evidenced by social media posts, di suspect na outspoken critic of Islam, and don promote conspiracy theories on top one plot to create Islamic supremacy for Europe.

Map of Germany wey show di location of Magdeburg and di capital, Berlin

Di Friday incident no be di first time pipo go dey attacked for Christmas market for Germany.

For 2016, Anis Amri, one Tunisian man wey fail to gain asylum for Germany and get links to di so-called Islamic State (IS) group, bin drive one trucks enta crowds wey gada for one church market for Berlin. E kill 12 pipo and injure 49 odas.

Two years later, one gunman open fire for one Christmas market for di eastern French city of Strasbourg. E kill five pipo and injure 11 odas. Police shoot and kill di gunman two days later.

Only last month, German Interior Minister Nancy Faeser bin tok about di need for "greater vigilance" for di highly popular markets - but say "concrete" indications of danger no dey.

Tori also say she point to tougher laws on weapons in public spaces afta one knife attack for Solingen, west Germany, for August wia three people die. Di incident bin bring back di debate on asylum and migration for Germany.