'Na four of my children go Ibadan funfair but na three come back'

Tragedy strike for Ibadan, di Oyo State capital on Wednesday 18 December wen crush happun for di Children Funfair wey di former Queen of Ile Ife Olori Naomi Ogunwusi bin organise.
Di stampede happun for Islamic High School, Basorun, di venue of di funfair wey Wings Foundation and Media partners Agidigbo Fm, bin organise.
Mr Musiliu no go forget dat day in a hurry as im 10-year-old daughter Shofiyat Musiliu dey part of di 35 children wey die for di stampede.
According to Mr Musiliu wey follow BBC Pidgin tok, im wife bin carry four children go di event.
"My wife bin leave for di event around 5:00am and at approximately 7:30am she call me to inform me say Shofiyat don faint and say dem don rush am to di hospital. Afta I hear dis, I hurry to di event venue becos she bin go dia wit four children.
Mr Musiliu say dem receive call from di hospital say dia daughter don die. E say dem bury Shofiyat on Thursday.
Mariam Salawu get di same experience wit di Mr Wale as she also take four children go di event and only return wit three as she lost one identified as six-year-old Ayomide.
How di crush take happun?
Mr Musiliu wife wey too dey down to tok explain to her husband say di crowd too plenty and many pipo bin dey locked out.
End of Di one wey oda users dey read well well
She say dose wey arrive early bin dey allowed to enta while larger group wey later arrive bin dey locked outside.
"Wen di founder of Agidigbo FM, Oriyomi Hamzat, finally arrive for di venue, di security open di gate. For dat moment, di waiting crowd seize di opportunity to force dia way through di narrow entrance, wey lead to di stampede," Mr Musiliu quote im wife.
Mrs Salawu also say na crowd wey rush inside wen Hamzat enta cause di stampede.
"We don dey gate since 5:00am. If to say dem open gate wen we arrive, wetin happun for no happun, no pikin for die.
"Na bifor 6am Oriyomi arrive. Di gateman no wan give Oriyomi key, Oriyomi snatch di key from am and open di gate. Na wen e open di gate pipo rush inside and begin fall ontop each oda. Oriyomi kon begin help dem. By di time I see my pikin, dem don crush am, e don shit, di pikin don die," she tok.
Although Mr Musiliu don find solace for im faith and "accept wetin happun as di will of Allah", e appeal to organisers of such event to take steps to prevent such tragedies for future.
Police arrest ex-Ife Queen and oda organisers
Di Oyo State Police Command on Thursday 19 December say dem gbab Olori Naomi Ogunwusi and odas sake of di tragedy.
For statement wey dem release, di police tok say na 35 pipo bin die for di stampede.
"So far thirty-five minors don dey documented to don die while six odas dey critically injured and on various medical interventions," di statement tok.
Apart from di ex-Queen wey be di main sponsor of di event, seven odas including di school principal also dey police custody.
Di police say dem don transfer di case to di Homicide Section of di State Criminal Investigation Department, Iyaganku and add say na di Deputy Commissioner of Police in charge dey lead di investigations.














