How 35 children die during end-of-year celebration wey Olori Naomi Ogunwusi organise for children for Ibadan

Wia dis foto come from, BBC/Naomi Ogunwusi
Thirty-five children die and plenti odas injure during one funfair wey former wife of Ooni of Ile-Ife, Naomi Ogunwusi, host for Ibadan.
Di incident happun for Islamic High School, Basorun, di venue of di family event wey Wings Foundation and Media partners Agidigbo FM, bin organise.
Di Oyo State Police Command officers, wey no want make we mention im name sake of say e no get authority to speak to reporters, tell di BBC reporter say three children don die, and more dey hospital.
Di policeman tok say na too much crowd wey dey di event cause di sad incident.
Among di tins wey pipo dey tok na say crowd bin gada from all ova di towns wey surround Ibadan flock go di end-of-year celebration program, especially afta dem hear di announcement for Agidigbo FM.

Some pipo go far to sleep overnight for di grounds of di Islamic High School, wey dey Bashorun area, wia di program hold.
So far, organisers of di program neva tok anytin about di incident.
Dis no be di first time wey di Naomi Silekunola Ogunwusi go host dat kain event.
She dey do am evri year under her charitable organisation, Women in Need of Guidance and Support (WINGS).
Who be Naomi Ogunwusi?

Wia dis foto come from, Others
Evangelist Silekunola Naomi na di second wife of di Ooni of Ile-Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi.
Bifor dia wedding for 2018, Ooni reveal her identity and tok say e don see im heart desire and describe her as prophet.
Born Naomi Oluwaseyi, di now Olori of Ile-Ife na around 1993 dem born her.
Olori Naomi bin marry di Ooni of Ife Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II for 2018.
Dem get one pikin togeda, Tadenikawo wey dem born for 2020.
Olori Naomi come from Akure, di capital of Ondo State.
For December 2021, Olori Naomi bin declare say "she no be queen of Ife again" as she don decide to move on.
She bin make di announcement on her Facebook page wia she say her marriage of three years no be arrange marriage.
"I bless di Lord Almighty for im faithfulness for di last three years of my marriage. For life journey, no be how far." Na part of wetin Evangelist Naomi write for Facebook page be dis.
Di queen also tok say she go like correct some impressions. She say dis decision no be sake of say di Ooni dey married to anoda queen.
Di Evangelist wey add Prophetess to her title na di founder of En-Heralds wey be church for Akure, Ondo State for southwest Nigeria.









