Five key tins from Nigeria 2025 budget wey Tinubu present to National Assembly

Wia dis foto come from, Presidency
President Bola Tinubu on Wednesday 18 December present di 2025 appropriation bill bifor di 10th National Assembly.
During di plenary on Wednesday, di president present di budget titled "Budget of Restoration: Securing Peace, Rebuilding Prosperity."
Di president give breakdown of di 49.7 trillion naira proposed budget to di National Assembly and wetin dem go allocate for each sector of di economy.
President Tinubu tok say di 2025 budget go drive inflation from 34.6% to 15% in 2025 while di exchange rate go improve from approximately 1,700 naira per US dollar to 1,500 naira, and base crude oil production go increase to 2.06 million barrels per day (mbpd).
President Bola Tinubu say di 2025 budget tell bold and exciting tori of di direction im administration go dey take to revamp di "socio-economic fabric of our society".
President Tinubu tok say dem dey target 34.82 trillion naira in revenue to fund di budget.
"Goment expenditure in di same year dey projected to be 49.7 trillion naira, including 15.81 trillion naira for debt servicing.
"Total of 13.08 trillion naira, or 3.89 percent of GDP, go make up di budget deficit. Dis na ambitious but necessary budget to secure our future," President Tinubu tok.
"Di budget project inflation go go down from di di current rate of 34.6 percent to 15 percent next year, while di exchange rate go improve from 1,700 naira per US dollar to 1,500 naira, and base crude oil production go improve to 2.06 million barrels per day (mbpd)."
How goment go take spend di 2025 budget allocations
President Bola Tinubu break down di allocation for major sectors.
- Defence and Security: 4.91 trillion naira
- Infrastructure: 4.06 trillion naira
- Health: 2.48 trillion naira
- Education: 3.52 trillion naira
Security
President Tinubu tok say di budget dey significant funding for di military, paramilitary, and police forces to secure di nation, protect borders, and consolidate goment control ova "evri inch of our national territory".
Tinubu promise say im administration go continue to provide Nigeria security force wit di modern tools and technology wey go keep Nigerians safe.
"Di officers, men, and women of our Armed Forces and di Nigerian Police Force be di shields and protectors of our nation," di president tok.
"Our administration go continue to empower dem to defeat insurgency, banditry, and all threat to our sovereignty. Our pipo no go live in fear - weda on dia farmlands, highways or cities. By restoring peace, we restore productivity, revive businesses, and rebuild our communities."
Infrastructural development
President Tinubu tok say im administration don already start key projects on di Lagos-Calabar highway and Sokoto-Badagry highway wey go get impact in di lives of Nigerians and drive economic output.
E tok say di renewed hope infrastructure development fund go improve investments in energy, transport, and public works by leveraging on private capital wey go help to complete key projects wey go drive growth and create jobs for Nigeria.
Education
President Tinubu tok say dem don make provision for 826.90 billion naira for infrastructure development in di educational sector for di 2025 budget.
Di allocation also cova di Universal Basic Education (UBEC) and di nine new higher educational institutions.
Health
Di president say dem don allocate 402 billion naira for infrastructure investments in di health sector for di 2025 budget and anoda 282.65 billion naira for di Basic Health Care Fund.
E promise say hospitals go dey revitalised wit beta medication, resources, wey go provide Nigerians wit quality healthcare.
"Dis dey consistent wit di federal goment planned procurement of essential drugs for distribution to public healthcare facilities nationwide, improving healthcare access and reducing medical import dependency," di president tok.
E add say Universal Health Coverage initiatives go strengthen primary healthcare systems across Nigeria.
Agriculture
President Bola Tinubu tok say im administration go support farmers wit funding wey go reignite productivity.
E add say food security no dey negotiable and dem go take bold steps to ensure say evri Nigerian go fit feed conveniently, and Nigerians no go go to bed hungry.
"Increasing agricultural production dey central to our food security agenda, but insecurity don cripple dis vital sector. We go support our farmers wit funding and inputs to reignite productivity," President Tinubu tok.









