Boy wey court sentence to death at age 17 for tiffing fowl, fit get pardon 10 years afta

Segun Olowookere

Wia dis foto come from, Remi Tunde

Read am in 4 mins

Osun State govnor Ademola Adeleke don order full investigation into di tori of one young man wey one court for di state sentence to death by hanging on top accuse say e tiff fowl for 2010.

Di govnor also order di state Attorney-General and Commissioner for Justice to begin di process on how di young man go take regain im freedom bifor di end of di year.

Segun Olowookere be 17 years old for 2010 wen e chop arrest along im accomplice, Morakinyo Sunday.

Di govnor take dis action afta one podcast interview wey don go viral, show as di parents of di boy take appeal to am to grant dia only child pardon.

"We dey beg di govnor Ademola Adeleke to help us pardon our son. Make e pity us as we no born pass dis one child. Di judge bin rule then say na only govnor fit give di boy freedom, we dey beg am to please pity us, show us mercy and free our son." Di parents tok.

Govnor Adeleke for statement say im don direct di Commissioner for Justice to initiate processes to grant prerogative of mercy to di young man.

"I don read about di case. I recognize separation of powers for our democracy," e add.

Osun state govnor Ademola Adeleke

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke/X

How di mata take start

Na for 2014, one High Court for Okuku Osun state southwest Nigeria sentence Segun Olowookere and anoda Morakinyo Sunday to death by hanging on top accuse say dem tiff fowl and eggs for 2010.

Di policeman wey carry di mata go court tok say di young boys use force enta di house of one Mr Balogun Tope for April 2010 and tiff some of im belongings.

Di prosecution team, wey di state Solicitor-General Mrs Abiola Adewemimo bin lead bin call six witnesses and tender several exhibits during di prosecution wey prove say Segun commit di crime.

Di prosecution during di hearing also tok say di convicts confess to di crime say dem tiff di complainant fowls.

Justice Jide Falola for im ruling convict dem on only three counts: to death for conspiracy; life sentence for robbery, and three years imprisonment for stealing.

E also recommend say di govnor fit decide to exchange di death sentence to 10 years imprisonment, considering di age of di convicts.

"Dem charge di convicts wit conspiracy, robbery and stealing contrary to Section 6(b) and 1(2)(a) of Robbery and Firearm (Special Provisions) Act, cap R 11 Laws of Federation of Nigeria 2004 and Section (390)(1) Criminal Code Law, Cap 34, Laws of Osun State, 2002." Vanguard report.

However, Segun on several occasions deny di accuse. Im parents also claim say dia pikin no fit tiff fowl as e no even dey chop chicken.

Di sentence at di time bin spark tok-tok for Nigeria as many pipo feel say di sentence dey too harsh.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Di parents of Segun for one interview on top one podcast wit Biola Adebayo explain how di mata take start and dem beg for im release.

According to di parents, na for 2010 some policemen bin come dia community for Osun state begin arrest young pipo on top accuse say dem tiff fowl and eggs.

Dia son wey be 17-year-old at di time dey among di pipo dem arrest.

"I dey shop dat day around 11:00am wen police storm di area, shoot for air, all of us run but dem pick one boy wey dem catch put for dia motor, dem later release di boy. But dem later come our house for evening and arrest my son." Segun father tok.

Segun papa explain say na wen im reach di station, e find out say di complainant na im relation. All attempts to prove im son innocence bin dey abortive till court find am guilty and sentence am to death.

E say na since den, dem don dey move from one correctional facility to anoda and currently e dey for di notorious Kirikiri maximum security prison for Lagos state wia e don dey on di death row wing.

For years, Olowookere parents, human rights groups plus oda Nigerians don dey fight for im release.

Nigeria neva carry out any execution since 2012 but currently more dan 3,400 pipo dey on death row.

Skip YouTube post
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites. YouTube content fit contain adverts.

End of YouTube post