18-year-old Briton chop prison sentence for Dubai sake of sex wit 17-year-old girl

Marcus Fakana inside school uniform

Wia dis foto come from, Detained in Dubai

Wetin we call dis foto, Marcus Fakana don dey unable to leave di kontri since September
    • Author, Harry Low
    • Role, BBC News
  • Read am in 3 mins

Eighteen-year-old Briton wey get sexual relationship wit one 17-year-old British girl for Dubai wen di pair go on holiday wit dia families, don chop one year prison sentence, one campaign group tok.

Marcus Fakana, of Tottenham, north London, start di secretive holiday romance for September wit anoda Londoner, wey don be 18 years now.

Afta returning home and seeing fotos and chats, di girl mama report di relationship to Dubai police, wey arrest Fakana for im hotel. Sex wit anoda pesin age under 18 dey illegal for Dubai.

Detained in Dubai call di judgement "utter disgrace" and tok say Fakana go appeal di "unreasonable" sentence.

Di organisation, wey dey help foreigners abroad and international authority on UAE law, add say Fakana feel "abandoned by di British goment".

One UK Foreign, Commonwealth and Development Office tok-tok pesin say: "We dey support one British man for di UAE and we dey in contact wit im family."

Dem don approach di Dubai Public Prosecutor office for comment.

Radha Stirling, di founder and chief executive of Detained in Dubai, tok say Fakana, no fit comot from di kontri since September, e dey "desperately hope" to return home dis week.

"But prosecutorial mishandling in di first stage of di case mean say dem no hear am as misdemeanour wen dem suppose hear am," she tok.

"Di family don issue plea to Dubai ruler, HH Sheikh Mohammed Al Maktoum, to spare Marcus for consensual sex wit anoda British citizen."

Ms Stirling add say dem go deport di teenager afta im sentence.

She also tok say im parents "no know wetin to do" and don return to London witout dia son to resume dia work for warehouse and as cleaner.