Bobrisky, Betta Edu, Junior Pope, national grid make di list of wetin Nigerians search for pass for 2024

Wia dis foto come from, Bobrisky/Betta Edu
Google don release di list of wetin Nigerians search for pass for 2024.
According to di ogbonge search site, some of di topics wey Nigerians search for well-well wey bin trend include crossdresser Bobrisky, former Minister of Humanitarian and Poverty Alleviation, Betta Edu, musician Shallipopi, di 'Ogechi' Lyrics, and Iphone 16, among odas.
Di search site add say wetin Nigerians search for inside 2024 na mostly about ogonge pipo, influential individuals, actors, musicians, topics, questions, and oda subjects.
For di statement wey Google release wetin Nigerians mostly search for show say di pipo for di West Africa kontri dey more interested in politics, di economy, dem bin also dey interested in di US elections, di new national anthem, and di national grid. Dis na di issues wey top di search for di news section.
For entertainment Nigerians bin wan know about pipo like Bobrisky, wey lead di list of pipo wey trend dis year.
For di music section in 2024, pipo search well-well for artistes like Shallipopi and Khaid, and dem also dey for di overall personalities list.
Di song wey top di searches na "I Don't Care" wey Boy Spyce sing and "Ozeba" by Rema and "Commas" wey Ayra sing follow for top songs.
Nigerians also try to know di lyrics of different songs, and di lyrics of "Ogechi " "Ozeba", and "Omemma wey Chandler Moore sing " lead di searches for di lyrics category.
For di movies category Nigerians show strong interest for movies like "A Tribe Called Judah", "Treasure In The Sky", and "Damsel" as dem top di movie charts.
Di US presidential election top di list of queries. Nigerians bin also search to know di meaning of words like "demure," "steeze," and "pet peeves".
Di top TV series category show say Nigerians bin get interest for series like "Supacell", "My Demon", and "Queen of Tears".
Taiwo Kola-Ogunlade, wey be di Communications and Public Affairs Manager, Google West Africa say "di 2024 Year in Search offer a unique lens into di questions, interests, and conversations wey bin shape di lives of Nigerians dis year.
See di full list of trends for 2024
News
US elections, New national anthem, National grid, Minimum wage, Ibadan explosion, Edo State election, Protest in Nigeria, Labour strike, Heat wave in Nigeria, and Student loan.
Personalities (Nigerian)
Bobrisky, Betta Edu, Shallipopi, Khaid, Bukunmi Oluwashina, Sharon Ooja , Adanma Luke, Yahaya Bello, Mike Ejeagha, Farooq Oreagba
Personalities (Global)
Donald Trump, Kai Cenat, Kamala Harris ,Tyla, Diddy, Joe Biden, Skepta, Paul Biya Tyra Banks, and Vybz Kartel.
Personalities (Sports)
Nico Williams, Nwabali, Leny Yoro, Cole Palmer, Ruben Amorim, Manuel Ugarte, Pedro, Neto, Rodri, Joshua Zirkzee, and Dani Olmo.
Loss (death)
Junior Pope, Mr Ibu, Herbert Wigwe, Sisi Quadri, Ifeanyi Ubah, Aduke Gold, Onyeka Onwenu, Amaechi Muonagor, Liam Payne, and Rukayat Gawat.
Meaning
Demure, Steeze, Pet peeves, Moots, Naira Mutilation, Taraban Refect, Pookie, Ozeba, Abido shaker.
Lyrics
Ogechi, Ozeba, Omemma by Chandler Moore, Marhaba, xxxtentacion Hope,
Commas by Ayra Starr, Twe Twe, Abanikanda, New national anthem of Nigeria
Songs
I don't care by Boy Spyce, Ozeba, Commas by Ayra Starr, Twe Twe by Kizz Daniel
Piece of my heart by Wizkid, Egwu by Chike Double by Kizz Daniel, Ogechi by brown Joel, Twe Twe remix ft Davido, Tshwala bam by TitoM and Yuppel
Movies
A Tribe Called Judah Treasure In The Sky Damsel
Rebel Ridge, Dune, Venom, Breath Of Life, Avatar, The Last Airbender, Netflix Lisabi, The Idea Of You
Devices
Iphone 16, Infinix Note 40, Redmi 13C, Redmi 14C, Infinix Hot 40
Infinix Hot 50 Pro Plus Redmi A3, Tecno Pop 9, Tecno Spark 20, Infinix Smart 8
Series
Supacell, My Demon, Queen Of Tears, Queen Woo, Shogun, Yellowstone, House Of The Dragon, Deadpool, The Boys, Marry My Husband
Questions
How much is dollar to naira today
How to get perfectly defined curls for African hair
Who won the us presidential election
How to hype up your sports team that you support
Why are ice baths good for muscle recovery
Who won the ballon d'or 2024
How many seconds are in a day
Who won the Grammy award 2024
What is the meaning of steeze
How much is iphone 16









