US release new visa directive for Nigerian immigrant applicants

Wia dis foto come from, Getty Images
Di United States Mission for Nigeria don introduce new visa application process for Nigerians wey wan relocate go America.
From 1st January 2025, immigrant visa applicants go need to visit di Consulate General for Lagos, Nigeria two times during di visa process.
Dis informate na for pipo wey dia interview dey scheduled afta 1 January 2025, di embassy tok for statement on dia X account on Tuesday, 10 December.
Di change dem say na to make di process dey more efficient and to reduce delay.
According to di U.S. Department of State Consular Affairs, di new process go help applicants prepare for dia visa interview and to prevent any delay for di processing of dia immigrant visa.
Di new immigrant visa application process
Di mission say applicants go need to visit di consulate two times during di application process.
Di mission explain say di first visit to di U.S. Consulate for Lagos na for In-Person Document Review wit one consular staff member to ensure say di applicant dey prepared for dia visa interview.
Dem say dis compulsory review go give di applicant opportunity to get any missing documents ahead of im visa interview to avoid delays for di application process.
"You no need to schedule appointment for di In-Person Document Review. Di Consular Section go notify you through email of di document review appointment date wey go be approximately be two to four weeks ahead of your visa interview".
Di second visit na for di Visa Interview wit a Consular Officer.
Di visa interview go hold on di date and time wey di National Visa Center (NVC) schedule am for. If you no complete di In-Person Document Review bifor your visa interview, you go dey required to reschedule your appointment according to di mission statement.
Applicants must also bring different documents come di In-Person Document wey include a valid passport, birth certificates, medical records plus police certificates for applicants ova di age of 16.
Oda steps to prepare for di immigrant visa interview according to di statement from di mission na to create online account, do a medical exam for Nigeria, complete di pre-interview checklist and document pickup for Lagos or Abuja.
Dis dey come as America President-elect Donald Trump recently vow to end automatic citizenship for anybody dem born for di country.
Trump promise to issue "a lot" of executive orders, including on immigration, energy and di economy, after dem inaugurate am on 20 January.
Trump tell tori pipo NBC say e go through executive action look to end di so-called birthright citizenship, wey dey entitle anybody dem born for US to American passport, even if dem born dia parents elsewhere.
Birthright citizenship come from di 14th Amendment of di US Constitution, wey say "all persons born" in di United States "be citizens of di United States".
"We go have to change am," Trump tok. "We go maybe get to go back to di people. But we have to end am."
Trump also say e go follow through on im campaign pledge to deport undocumented immigrants, including those with family members wey be US citizens.
"I no wan break up families," e tok, "so di only way you no go break up di family na say you go keep dem together and you have to send dem all back."









