Here na wetin you need to know about di changes for UK visa application

UK Visa

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Di United Kingdom don announce say dem don change dia visa issuing partner from TLScontact to VFS Global.

Dem say dis go affect pipo for Africa, Europe, di Middle East and Central Asia.

For some of di locations, di change don already start from September dis year, but for odas e go start from January 2025.

"If your visa application dey affected, you no need to panic, di change no go affect di decision on your application or how long e go take for di decision to come.", di UK goment office for Nigeria tok.

Wetin to do

You suppose get email from both TLS and VFS to tell you wetin to do.

And to know weda di email dey genuine, e suppose end wit '@tlscontact.com' or '@vfsglobal.com'.

"Read all emails you receive from TLScontact and VFS Global. Dem fit contain actions wey you need to take to kontinu your application," a statement on di UK goment website tok.

Di statement add say visa appointments fit no dey available for some places for a short time.

"If dis happen, wait until wen VFS Global go start operating visa application centres for your location, den sign in to continue your visa application," dem advise.

VFS Global announce for dia X handle on Thursday say pipo for Nigeria fit visit dia UK Visa Application Centres for Abuja and Lagos to process dia application.

But di customer suppose first book appointment online for dia website: visa.vfsglobal.com.

For October last year, di UK High Commission for Nigeria bin announce say dem don open visa application centre for Enugu State for di southeastern region of di kontri.

But wit dis new change, e appear say dat arrangement don end, bicos na TLScontact bin dey run dat Enugu centre.

Nigeria and India na di two major markets for UK student visa for di world.

For January dis year, as part of effort to reduce di number of pipo wey dey come in using student visas, di UK bin tighten dia student visa rules as dem tok say pipo wey get student visas no go dey able to bring dia dependents wit dem.

Nevertheless, for August dis year, di British High Commissioner to Nigeria, Richard Montgomery, during a visit to di Chairman of di Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM), Abike Dabiri-Erewa, tok say "approximately 430,000 visa applications by Nigerians bin dey approved so far in 2024".