UK ban care workers from bringing dependants - Wetin you need to know

About 120,000 dependants go dey affected

Wia dis foto come from, Getty Images

Di goment of di United Kingdom (UK) don issue one new migration policy wey go affect care workers wey dey bring dia families come di kontri.

UK say dis new laws wey comot on 11 March 2024 na to cut migration and tackle care worker visa abuse by oversea pipo wey dey come di kontri.

According to di UK Home Office, all care givers wey go come di kontri go need register if dem dey sponsor any migrants.

According to di Home Secretary, James Cleverly, im tok say care workers dey contribute to dia society but dem no fit dey look plenti abuse and manipulation wey dey happun for di system.

“Care workers dey make helpful contribution to our society, taking care of our loved ones in times of need. But we we no fit justify inaction for di face of clear abuse, manipulation of our immigration system and unsustainable migration numbers.”

Cleverly add say e no dey right if dem allow such abuse and manipulation for di immigration system to kontinu.

“We promise di British pipo action, and we no go rest until we deliver on our commitment to bring numbers down substantially. E no dey right or fair to allow dis unacceptable situation to continue.

Di Secretary say dis new plan dey fair as dem dey protect di British workers while pipo wey dey enta di kontri to work and study go add value and grow di UK economy.

120,000 pipo wey arrive last year go dey affected

Di UK Home Office say dem wan cut net immigration - di difference between di number of pipo wey dey go live for di UK and those wey dey comot bin reach a record of 745,000 for 2022. Dem add say e go also help to cut down unsustainable levels of legal migration.

“Care workers no go fit bring dependants, afta a large amount of 120,000 dependants follow about 100,000 workers enta di kontri last year (2023).

“Care providers for England wey dey act as sponsors for migrants go dey required to register wit di Care Quality Commission (CQC) wey dey regulate di Health and Social Care to bring down worker exploitation and stop abuse within di sector.”

Dis mean say a total of 300,000 pipo wey dey eligible to go di UK last year no go dey eligible again.

Home Secretary, James Cleverly MP, say dem don notice say care workers dey collect work visa under false pretence and e dey also undercut British workers.

“E get clear evidence say care workers dey collect visas under false pretences, travelling thousands of miles for jobs wey no exist and some go get paid far below di minimum wage required for dia work. E dey exploit dem and also undercut British workers.”

Di UK Minister for Social Care, Helen Whately MP, say dem go review di graduate route for international students to prevent abuse and protect di integrity of higher education for UK.

Di Migration Advisory Committee (MAC) wan ensure say di graduate route wia dem don grant a total of 175,872 visas go fit attract di best and brightest to di UK.

Dis na sake of report say international students wey dey enta di kontri to study without meeting di academic entry requirements don reach 250% between 2018 and 2022.

Di goment dey clear say any job role wey go dey go require pipo wey dey skilled, and no sector go dey entirely dependent on immigration.

Minimum salary for skilled worker don increase by 48%

Dis new policy go also include an increase for di minimum salary wey any skilled worker go get before arriving di UK.

“From 4 April, di minimum salary for those wey dey arrive on di Skilled Worker visa go increase from £26,200 to £38,700 – a 48% increase. Dis go reduce numbers, pressure and prevent employers wey dey recruit cheap labour from overseas.”

“Di minimum income requirement for family visas go also rise go £29,000 from 11 April and by early 2025, e go increase go £38,700, to ensure say dependants wey dem bring to di UK dey financially supported.”

Wetin don happun before

Migration through work visa na di most popular visa afta student dependant visa.

For 2023, United Kingdom State for Home Office Department bin block international students to dey bring dependants come dia kontri.

In May 2023, di United Kingdom under di former Interior Secretary Suella Braverman, restrict international students wey wan travel wit dia family to United Kingdom from January 2024 - di new law say na only PhD students fit bring dia family.

Braverman bin say di policy na to reduce di number of dependants wey dem go dey issue visa come United Kingdom evri year.

Di United Kingdom goment release data say Nigerians get 60,506 wey be di highest number of international students dependants for dia kontri from 2019 to September 2023.

Kontri wey health workers fit carry dia family enta on work visa

E get some kontris wey still dey allow make workers carry dia family members enta.

Australia

Di Australia goment dey offer health workers and dia family different visa options for short-term, long-term, and permanent residence. Di kontri demand for skilled health dey high for dia public sector.

Finland

Foreign health workers fit work for Finland afta dem don already get dia employers sponsorship application. Immigrants from Nigeria go need dia airport transit visa before dem go fit enta di kontri.

Canada

Canada Health sector dey important to di Canadian goment, dem don invite 500 skilled health workers make dem apply come join di kontri public health sector.

Sweden

As foreign health workers for Sweden, you need get di Swedish medical license before you go fit practise legally for Sweden. Before you travel go Sweden, make sure say you don get employment as health worker.

Germany

Germany dey among di kontris wey you go need apply for work visa as individual but you no fit carry your family until you apply for family reunion visa. So, you go dey financially responsible for di relatives.