Who be Afe Babalola?

Wia dis foto come from, Afe Babalola
Many pipo for Nigeria dey tok about Afe Babalola one ogbonge lawyer for di kontri.
Di reason why im tori full pipo mouth na sake of im alleged defamation case wit human rights lawyer Dele Farotimi.
Last week Tuesday, Ekiti police arrest Farotimi from im office for Lagos sake of dis mata.
Di activist dey face accuse of spreading false information against Babalola for inside im book wey im title 'Nigeria and its Criminal Justice System'.
During one court proceeding, Oga Farotimi plead not guilty to all 16 counts of defamation wey dey sama on top im head.
Di court remand Oga Farotimi for di correctional facility for Ado Ekiti afta im arraignment, and adjourn di case to 10 December for di hearing of im bail application.
Former Vice President, Atiku Abubakar, na di latest politician to react to dis case e say "@DeleFarotimi, a lawyer and tireless advocate for human rights, dey for prison custody no be for any crime but for di supposed "crime" of persistently speaking truth to power.
Di former Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate tok dis for post on im X handle on Tuesday.
Presidential candidate of di Labour Party for di 2023 election Peter Obi also chook mouth for di mata for a post on im X account on 4 December wia e say hearing say dem remand Farotimi for prison over allegation of defamation dey disturbing.
"Di handling of di case involving human rights lawyer @DeleFarotomi no gel with democratic norm wey guarantee freedom of expression and innocence until found guilty before a law court.
E dey curious say di Nigeria Police, wey dey struggle with plenti crime all over di place, now dey indulge in civil cases on half complaints and dey rush go court fast fast." Im statement tok in part.
Who be Afe Babalola?

Wia dis foto come from, Afe Babalola University
Aare Afe Babalola as dem dey call am for Nigeria na ogbonge lawyer and businessman wey don contribute a lot to di legal profession for Nigeria and outside di kontri.
Afe Babalola come from Ekiti state di south west part of di kontri. Na im be di founder of Afe Babalola university.
Di 95-year-old na highly accomplished lawyer, wey don lead some of di most celebrated cases for Nigerian legal history, wia im represent high-profile clients, including goment institutions, multinational corporations, and individuals.
Im influence go beyond di courtroom. Im (Emmanuel Chambers), Afe Babalola & Co. na one of Nigeria leading law firms.
Tori be say Aare Babalola don train ova 300 lawyers, including 14 Senior Advocates of Nigeria (SANs), judges, and attorneys-general, many say im chambers na one of di most significant contributors to di legal profession for Nigeria.
Im become senior advocate of Nigeria for 1987.
Babalola na scholar and author, wey don write several legal text, including injunctions and Enforcement of Orders and Law and Practice of Evidence for Nigeria.
Im contributions to legal education don see am teach for Nigerian Institute of Advanced Legal Studies and deliver lectures for prestigious universities like di University of Lagos and di University of Ibadan.
Im get column for Nigerian Tribune newspaper wey im title 'You and di law' di column dey educate di public on legal matters.
Afe Babalola na father, im daughter Bolanle Austen-Peters na award-winning Nigerian movie and theatre director, producer. lawyer and cultural entrepreneur.
Aside im legal and educational contributions, Babalola na committed philanthropist.
Key Achievements:
- Senior Advocate of Nigeria (SAN), 1987.
- Officer of the Federal Republic (OFR).
- Commander of the Order of the Niger (CON).
- Pro-Chancellor and Chairman of di Governing Council, University of Lagos (2001-2007).
- Founder and Chancellor, Afe Babalola University, Ado-Ekiti (ABUAD).
- Queen Victoria Commemorative Award winner, Oxford UK.
- Fellow, Nigerian Institute of Advanced Legal Studies.
- Honorary Doctor of Laws from di University of London, Ekiti State University, University of Lagos, and more.
Source: Afe Babalola









