Wetin Dele Farotimi do wey don land am for prison, di 16 count charges police sama am

Dele Farotimi

Wia dis foto come from, Dele Farotimi/Facebook

Read am in 4 mins

No be tori again say Court for Ekiti state, Southwest Nigeria don remand human rights lawyer and activist Dele Farotimi for prison.

Oga Farotimi go dey sanko until December 10. Di activist dey face 16 count charges wey border on alleged defamation.

Tori bin comot on Tuesday say police arrest Farotimi but nobody bin know im offence. Dem gbab am for im office for Lagos and move am go Ado-Ekiti.

Court documents wey BBC Pidgin sight show say na ogbonge lawyer Chief Afe Babalola SAN carry di matter go police wey lead to im arrest.

Wetin dey di court papers

Koko be say Chief Afe Babalola write 31 page petition to di police wia e accuse Farotimi of alleged defamation and intent to cause fear and to alarm di public or disturb public peace.

Acting on di petition, police arrest di activist for Lagos, carry am go Ekiti state wia dem charge am to court. Di document list 16 count charges against am.

Di court papers show say di case na between Commissioner of police and Dele Farotimi.

Count one of di charges read say oga Farotimi write book wey im title ‘Nigeria and its Criminal Justice System’, say e use di book sama accusation on Chief Afe Babalola say e corrupt Supreme Court to procure fraudulent judgement for im clients.

Di document claim say di writer know say wetin im write inside di book na lie, but e go ahead to write in order to destroy the name and reputation of di ogbonge lawyer.

Anoda of di charge say di author use di book push false allegation wey go wunjure di Senior Advocate reputation and cause am hatred, contempt, ridicule and damage to im profession.

Count five of di charges say di writer allegedly criminally defamed di person of chief Afe Babalola by accusing am say e corrupt di Supreme Court to collect better judgement for im client.

Di court papers also accuse Farotimi say e "defame and expose to hatred, contempt and ridicule office of Afe Babalola law chambers and im lawyers wey include Olu and Daramola, Olu Faro."

According to di court papers di writer allegedly commit offense against section 373 of di Criminal Code Act and dey liable to punishment under section 375 of same act.

‘Nigeria and its Criminal Justice system’

Book wey Dele Faorimi write wey make police arrest am

Wia dis foto come from, Dele Farotimi/Facebook

Wetin we call dis foto, Dele Farotimi and a copy im book

Dele Farotimi bin write and publish di book for November 2024. Di book get hard copies and e-versions.

Some details from inside di book tok about one land case wey happen for Eti-Osa LGA of Lagos state wia di Afe Babalola lawyers represent dia client and win di case.

Di book also get many oda tori of court cases wey e feel say di judiciary no handle well.

Dele Farotimi na lawyer, public speaker, and author.

Dem call am to di Nigerian bar for 1999 until im retire for 2018 afta years of legal service.

Im na activist and e begin ginger for better Nigeria since im undergraduate says for Lagos State University (Lasu) – wia e later become president of dia Student Union between 1994 and 1995.

Since den, Farotimi don become activist wey dey tok about bad governance and advocate for good leadership for Nigeria.

Im don write oda books including ‘Do Not Die In Their War'.

For 2023, di activist campaign for di presidential candidate of Labour Party, Peter Obi.

Chief Afe Babalola SAN na ogbonge lawyer and philanthropist. Na im be di owner of Afe Babalola law chambers.

Di law chambers don produce over 300 lawyers and 30 Senior Advocates of Nigeria plus including Attorney Generals.

Na him own di Afe Babalola University for Ekiti state plus oda enterprises.

Di senior lawyer dey aged 95.