'God keep me for dia presence but I no know' – Anthony Joshua dey struggle wit coping afta crash

Wia dis foto come from, Anthony Joshua/James Chance/Getty Images
British boxer Anthony Joshua don share how e dey cope afta e get injury for one car crash for Nigeria wey kill two of im close friends.
For one Instagram post wey show pictures of di two men, Joshua write say:
"100% e hard for me, but I know say e hard pass for dia parents."
E add say "My mind strong."
Dis na di first time wey e dey tok directly about how e dey feel since di crash happun.
Joshua im close friends and team members, Sina Ghami and Latif 'Latz' Ayodele, die for di accident. Dem bury dem last week.

Wia dis foto come from, Carmen Mandato via Getty Images
Di former two-time world heavyweight champion dem carry go hospital for Nigeria and e return go UK some days later, as e reach back dis weekend.
Bifor now, Joshua share two pictures for Instagram. One show am dey siddon wit im mama and members of di victims families, including di mothers of Ghami and Ayodele. One of dem dey hold picture of Ghami.
Di caption for di post be "My Brother's Keeper."
Di driver, Adeniyi Mobolaji Kayode, 46 years old, don face charge for magistrate court for Sagamu, Ogun State.
Police sources tell BBC say e dey face charges including causing death by dangerous driving.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Profile of Sina Ghami/Kevin Ayodele
Sina Ghami na Joshua strength and conditioning coach of more dan 10 years, e help am prepare for major clashes for im career including dis month victory, wey e beat Jake Paul.
E also co-found Evolve Gym for London. Di gym website say Ghami na qualified sports and exercise rehabilitator wey specialise in musculoskeletal injuries and corrective exercise.
Di gym say dem go close on 30 December "as we mourn di loss of our beloved owner".
E don work wit athletes for di National Football League (NFL), National Basketball Association (NBA) and Michigan State University football team.
Sina bin don also work with many big name athletes like Le'Veon Bell from di Pittsburgh Steelers (NFL) and Draymond Green from di Golden State Warriors (NBA).
Latif "Latz" Ayodele na Joshua personal trainer.
Im passion for di gym dey clear on im social media pages, as im dedication to Islam.
"Finding Islam for 2012 has been my biggest blessing," e write for one pinned post from 2020.









