Why Rivers State Assembly wan impeach Govnor Fubara?

Rivers State Govnor, Siminialayi Fubara wear black cloth with red cap, e sidon for chair dey smile wit im hands crossed. Nigeria flag dey for di background.

Wia dis foto come from, RSGH

Wetin we call dis foto, Rivers State Govnor, Siminialayi Fubara
Read am in 5 mins

Di political crisis for Rivers State don get anoda twist as members of di State House of Assembly don begin impeachment proceedings against Govnor Siminalayi Fubara and im deputy, Ngozi Odu.

E hapun during plenary wey dey presided over by Speaker of di Rivers State House of Assembly, Martin Amaewhule on Thursday 8 January, 2026.

Majority Leader, Rivers State House of Assembly, Major Jack, read out di notice of allegations and gross misconduct against Fubara.

Relying on Section 188 of di Nigerian Constitution, Jack list seven points of alleged gross misconduct against Fubara wey include:

  • Di demolition of di Assembly Complex.
  • Extra budgetary spending.
  • Withholding funds for di Assembly Service Commission.
  • And refusal to obey di supreme court on di financial autonomy of di house and appointment of pesins to occupy positions in govment without screening and confirmation by di Assembly among odas.

Twenty-six members of di Rivers State House of Assembly sign di notice afta di Majority leader Major Jack lay im notice bifor di Speaker.

Di speaker, Amaewhule say dem go serve di notice of impeachment to di Govnor in seven days.

Afta dat, di deputy leader, Linda Stewart also bring forward di notice of gross misconduct against di Deputy Govnor Prof. Ngozi Odu.

Some of di gross misconducts allegations include:

  • Reckless and unconstitutional spending of public funds.
  • Obstruction of di House of Assembly from performing her constitutional duties as e dey outlined by di 1999 Constitution.
  • Conniving to allow unauthorized persons to occupy offices without proper screening by di legitimate House of Assembly.
  • Oda allegations na say she approach anoda group of pipo for budgetary approval instead of di legitimate Rivers State House of Assembly.
  • Seizure of salaries and allowances wey accrue to di RSHA and di Assembly Service Commission.
Martin Amaewhule

Wia dis foto come from, Rivers State House of Assembly

Wetin we call dis foto, DI Rivers State House of Assembly go send di impeachment notice to di Govnor within seven days

Speaker, Martin Amaewhule say e bin don observe say Govnor Fubara never present a budget to di Assembly since di lifting of di state of emergency and e wonder wia e dey spend money from - even though di budget wey di National Assembly approve for 2025 under di Sole Administrator still dey run.

Also, Amaewhule say di Guvnor dey appoint pipo into office without di screening and confirmation of di Assembly.

Di Govnor recently appoint some Special Advisers and do small cabinet reshuffle wia e reappoint di Commissioner for Sports, Christopher Green, to become di State Attorney General and Commissioner for Justice.

Also, di State Executive Council recently approve di budget for 2026 pending di presentation to di Assembly as Govnor Fubara say e go make sure say di Assembly Complex wey currently dey under reconstruction go dey completed so day e go present di budget to di Aseembly members for di new building.

Di govnor dey expected to respond to di impeachment notice wey di assembly go send within seven days and respond to di allegations wey dem put bifor am.

Breakdown of relationship between Wike and Fubara?

Dis latest development of di impeachment proceedings wey di state assembly don begin dey follow weeks of activities wey show say di relationship between di Rivers State Govnor Siminalayi Fubara and di FCT Minister Nyesom Wike don break down.

Di FCT Minister Nyesom Wike during im 'Thank-You tours' across di 23 local govment areas of di state to appreciate political leaders, party officials and grassroots supporters for di area for dia loyalty bing give hint.

E say gratitude and accountability na di foundation of enduring political relationships and accuse Govnor Fubara say e dey ungrateful and e never honour all di agreements dem reach after di lifting of di state of emergency and reconciliation.

Wike for one of di tours to Asari Toru LGA say, "wen a man make a mistake and come back to say, 'I dey sorry, I make mistake,' dat mistake fit dey corrected. No propaganda, no shouting and no battle fit solve problems. Only accountability and correction fit."

Wike say e don begin a rainbow coalition wey go produce all elective positions for di state for di 2027 elections.

Di rainbow coalition e dey tok about na di APC and PDP working togeda to produce winners for di election, like di model for di last local govment election wia im loyalists in di APC win 20 local govments of di 23 LGAs, while PDP only win just three local govments.

"Here, we no dey focus on political parties. Wetin we get na a family, a rainbow coalition. If you no belong to dis family, forget am. After di president, na dis family go determine di direction of di state." Wike bin tok.