‘No more acrimony, peace don come’ - Wike tok afta e meet wit Fubara for Aso Rock

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
“No more acrimony. Peace don finally come to di state.” Na wetin FCT Minister Nyesom Wike tok at di end of a peace meeting between im and Rivers State Govnor Siminialayi Fubara wit President Bola Tinubu for Aso Rock.
Photos of smiles and handshake between Govnor Fubara, di State Assembly members with Minister of FCT Nyesom Wike and President Tinubu don raise hopes of a possible end to di emergency rule for di state.
Govnor Fubara alongside Wike and Martins Amaewhule, speaker of di Rivers State House of Assembly and oda Assembly members meet with President Tinubu to broker a peace deal wey dey expected to return democratic governance to di state.
Dis meeting dey expected to be a crucial part of di peace building process since President Tinubu declare a state of emergency wey suspend elected state executives and di House of Assembly on 18 March 2025, over three months ago.
Afta di meeting, di FCT minister and Govnor Fubara say peace don return as dem don finally reconcile.
Wike say dem don agree to work togeda wit di govnor and di govnor too don agree to work with dem. E say dem be members of di same political family wey dey disagree sometimes but now, dem don settle and dem come togeda to inform Mr. president.

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Photos from di meeting suggest a breakthrough in efforts to resolve di political crisis for di state as one photo show di president with Govnor Fubara and FCT minister all dey smile and shake hands.
Oda photos show di FCT Minister and di govnor dey waka side by side with di Speaker Amaewhule and oda state lawmakers dey follow dem.
Govnor Fubara say e happy say dis day of reconciliation don come to be as e dey necessary and important for di peace and progress of Rivers State.
“With di help of di president and di agreement of di leaders of di state, peace don return to Rivers State. We go do evritin within our power to make sure say we sustain am dis time around.” Govnor Fubara tok.

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
How we reach here?
All dis crises arise from disagreement between Govnor Fubara and di FCT Minister Wike with many reactions wey include:
- Di attempt to impeach Governor Fubara by di Rivers State House of Assembly RSHA for October 2023 wey lead to a split in di Assembly as few Assembly members support di govnor while majority of dem side with di FCT minister.
- Di burning of di Assembly Chambers and subsequent destruction of Assembly complex and defection of di Assembly members wey dey led by Amaewhule from di Peoples Democratic Party, PDP, to di All Progressives Congress APC -sometin wey dem later deny say dem no ever defect.
- Court cases and counter court cases wey di Supreme Court later resolve as e recognise Martin Amaewhule as di Speaker of di RSHA and cancel di local goment elections wey Govnor Fubara bin don conduct.
- Di Supreme Court ask di govnor to re-present di 2025 state budget to di Assembly led by Amaewhule, but dem no fit reach an agreement on di day for di presentation bifor President Tinubu declare di state of emergency on 18 March 2025 and suspend both di govnor, deputy govnor and Assembly members.

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Many pipo don criticise di emergency rule wey see di appointment of a Sole administrator, Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas Rtd, from Cross River State to oversee affairs for di state.
E lead to many court cases wey dey challenge am for Federal High Courts both for Port Harcourt and Abuja as dem insist say a tsate of emergency no require di president to suspend di elected govnor and Assembly members and impose a non-indigene on di state to oversee affairs.
Even di appointment of sole administrators for di 23 LGAs for di State na anoda issue wey many criticize as dem say e no dey known to law and e only favour one party for di crises.
Odas also criticise di dissolution of boards and agencies for di state and even di one wey National Assembly don approve, over N1trillion 2025 state budget as well as clearing some officials for some boards.
Di approval of anoda Cross River State indigene, Michael Ekpai, to head di Rivers State Independent Electoral Commission RSIEC wey dey expected to conduct local goment elections also spark criticism.
But di main questions na weda dis reconciliation moves go bring an end to di emergency rule soon?
Wetin go happen to di court cases wey challenge di emergency rule wey di Federal High Courts never begin proper hearing for most of dem?
Wetin go happen to di recent appointments wey di Nigerian Senate approve, dem go still hold or dem go dey suspended?
All dis na wetin pipo dey wait to see how e go all play out.








