Champions league round of 16: Who fit meet who for di knock out phase of di UCL

Wia dis foto come from, Getty Images
Di 2026 season of di Uefa Champions League don dey enta im business stage afta di conclusion of di two-leg play-off to know who go qualify for di round of 16.
As e be now, 16 clubs don qualify for di round of 16 and each of di teams go know who dem go face afta di draws on Friday.
All di six clubs from di English Premier League - Arsenal, Chelsea, Liverpool, Manchester City, Newcastle and Tottenham Hotspur - qualify for di next round and dis don already make history.
Dis tori na to gist you evritin you suppose sabi about di round of 16 of dis year Champions League, who fit meet who, how di draws go take hapun and wen di matches go be.
How di last-16 draws go hapun?
Di clubs wey finish for di top eight of di league phase table go meet di eight players wey qualify through di play-offs, and from dis point, na knockout format over two legs, except for di final wey go be just one match for neutral ground.
Also, di clubs for di top eight go dey seeded for di draws and dis mean say dem go play dia second leg for dia home stadium.
Dis na di first season wey di position of clubs for di league phase table go also influence dia seeding for di quarter-final and semi-finals.
Clubs wey finish first to fourth for di league phase go dey seeded for di quarter-finals, and di first and second clubs for di league phase go dey seeded for di semi-final if dem reach dia.
Any club wey knock out seeded club go inherit dia seeding position, and also for dis round e dey possible for two clubs from one kontri to meet diasef.
Who fit meet Premier League clubs?
Clubs don already know dia possible opponents for di Champions League last 16.
Top seeds Arsenal go meet either Bayer Leverkusen of Germany or Atalanta of Italy.
Liverpool and Tottenham wey finish third and fourth for di league phase, go meet either Atletico Madrid or Galatasaray.
Nigeria striker Victor Osimhen, afta e help Galatasaray to beat Juventus on Wednesday tok say e go prefer make dem meet Tottenham dan Liverpool.
For di oda draws, Manchester City go face either Bodo/Glimt or Real Madrid, while Chelsea go meet either fellow EPL side Newcastle or last year cahmpions Paris St-Germain.
Newcastle go either play against Chelsea or Barcelona.
Here na di possible pairings in summary:
- PSG vs Barcelona or Chelsea
- Galatasaray vs Liverpool or Tottenham Hotspur
- Real Madrid vs Sporting CP or Manchester City
- Atalanta vs Arsenal or Bayern Munich
- Newcastle vs Chelsea or Barcelona
- Atlético Madrid vs Tottenham or Liverpool
- Bodø/Glimt vs Manchester City or Sporting CP
- Bayer Leverkusen vs Bayern Munich or Arsenal
January signings fit play?
Players wey sign for di January transfer window dey eligible to play for di Champions League knockout phase.
Dis mean say Manchester City go fit play dia new signings Marc Guehi and Antoine Semenyo and Tottenham go fit play Conor Gallagher wey dem sign newly from Atletico Madrid.
Mamadou Sarr also dey eligible to play for Chelsea afta dem recall am from im loan move to Strasbourg of France.
However, di clubs gatz register dia new players for dia Champions League 'A list' bifor di knockout play-offs in order for dem to fit participate.
Knockout phase draw and fixture dates
Di dates for di knockout phase of di 2026 UCL na:
Round of 16: 10 and 11 March - first leg; 17 and 18 March - second leg
Quarter-finals: 7 and 8 April - first leg; 14 and 15 April - second leg
Semi-finals: 28 and 29 April - first leg; 5 and 6 May - second leg
Final: 30 May
Di final go hapun for di Puskás Aréna for Budapest, Hungary.









