Jobs, cocoa crisis, security and oda tins to expect for President Mahama state of di nation address

Ghana president John Mahama dey expected to deliver im second state of di nation address since im win di 2024 elections to become president.
Di address dey happun at a time opposition parties and odas dey demand jobs wey di govment bin promise dem during di election campaign.
In fact oda tins dey happun around di same time including cocoa sector crisis – wia farmers don dey protest say govment slash di cocoa price.
Govment announce reduction of producer price from GHc 3.6k ($338) to GHc 2.6k ($244) per 64kg bag – sometin wey vex di farmers.
Di govment tok say dem reduce di price sake of global market prices for di commodity don fall.
Some of di farmers gada for di cocobod office to demand say make govment restore dia original cocoa price.

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY
Some citizens and civil society groups also plan to demonstrate against illegal mining (aka galamsey) on di same day di president wan deliver im address.
Waterbodies across di kontri still dey polluted sake of galamsey dey happun – even though govment say dem dey deal wit di illegal mining wahala.
But di Ghana police go court to put injunction on top of di demonstration.
Inside one statement, di police say dem go enforce di court order to stop di demonstrators wey plan to gather around di Accra sports stadium to demand proper govment action against galamsey.
"We don serve di demonstrators wit di court order -in di interest of public safety sake of e don dey happun di same time of di president address," di police tok.
Dem add say di organizers fit choose anoda date for di protest but make dem no gather today.

Wia dis foto come from, PAUL NINSON/BLOOMBERG VIA GETTY IMAGES
Some pipo say di action of di police dey prevent freedom of citizens to demonstrate.
Healthcare, security and oda tins about di economy dey expected to feature for di president address.
Inflation and exchange rate don reduce – import duties don reduce wey di govment remove some taxes, but opposition parties say di govment gatz to do more.
Di opposition new patriotic party (NPP) say even though dem no dey expect anytin new from di president, dem hope say he go speak about jobs, healthcare among odas.
Under article 67 of di 1992 constitution of Ghana, di president dey expected to deliver state of di nation address for di beginning of each session of parliament.









