Ghana officially begin to give license for industrial and medicinal cultivation of cannabis

Wia dis foto come from, AMOS GUMULIRA/AFP VIA GETTY IMAGES
Ghana don officially begin to issue licence for pipo to cultivate industrial and medicinal cannabis.
Dis dey hapun more dan one year afta parliament of Ghana bin pass di narcotics control commission bill, 2023 into law.
Dis law dey give di interior ministry di mandate to issue license for cultivation of dis type of cannabis.
For one press conference, di interior minister Mohammed Muntaka Mubarak confam say di narcotics control commission dey begin di process immediately.
"We dey invite Ghanaian entrepreneurs and investors to submit dia application for consideration."
Pipo fit visit any of di narcotics control offices across di kontri or dem fit visit dia website and online platform to apply.
"Pipo wey get licence to plant di cannabis no fit use dat same license to transport am unless dem get transport license also," di minister tok.
Di minister add say "dis license we go give, no dey transferrable, if you be partners for di cultivation, you gatz to apply for di license togeda as partners."
End of Di one wey oda users dey read well well
Di interior ministry also say one of di requirement bifor dem go issue di license be say di farmer gatz to get off-taker wey go collect di cannabis and use am for dia industries.

Wia dis foto come from, AMOS GUMULIRA/AFP VIA GETTY IMAGES
Some of di requirements to get license to grow dis cannabis
Di narcotics control commission wey dey in charge for dis sector say dem go follow strict processes.
Dem say dem go issue di license only to pipo wey qualify wey dem meet di requirement like security protocol, product traceability systems, quality assurance standards among odas.
Di issuance of di license go follow full compliance wit laws and regulations.
For di press conference to announce di beginning of di licensing, interior minister tok say dem no go allow make pipo "plant di cannabis for area wey dey 100 meters close to school campus or residential area."
"Officers of di narcotics control commission go enta farms and oda places wia dem dey plant dis cannabis unannounced to check say dem dey do di right tins afta dem collect di license."
Muntaka Mubarak also explain say di pipo dey responsible to "give quarterly returns, odawise dem go face fines."
Di narcotics control commission also warn di applicants for di license say dem gatz to go through di right channels wey dem for
- Deal wit narcotics control commission through di cannabis regulations department
- Avoid engaging individuals, groups or associations wey dey claim say dem dey facilitate di licensing process
- Follow only di official licensing process and guidelines
Dem warn say to still carry and use recreational cannabis be illegal for Ghana –wey dem go work wit di security agencies to enforce di law.
Under di Ghana law – di narcotics control commission Act, 2020 (Act 1019), di cultivation and possession of recreational cannabis be serious crime.
Pesin wey dey guilty of growing cannabis without license fit land dem for jail of up to 10 years or more.
Pipo wey dey guilty also fit get heavy fine.
Possession of large quantities of dis cannabis or to dey supply am fit land pesin for prison for up to 20 years wit repeat offenses.
Foreigners and oda travellers wey dey guilty of carrying cannabis go also face di law – dem fit go jail or face deportation.

Wia dis foto come from, MINISTRY OF INTERIOR
Ghana no legalize cannabis for smoking
Ghana neva legalize di cultivation or use of cannabis wey pipo dey smoke or use for toffee or di one dem dey put inside food to make high.
Wetin dem legalize be hemp for industrial purpose. Di two tins no be di same.
Di cannabis wey di law allow pipo to plant be di one wey get 0.3% thc (tetrahydrocannabinol) on dry weight.
Di 'thc' be di level of psychoactive element inside di cannabis; di tin wey fit make pesin high.
Dis mean dis kind cannabis - 0.3% thc level be below di level wey dey make pipo high.
But recreational cannabis wey many pipo call marijuana – get thc between 15% and 30%.
Dat mean say di level of psychoactive element inside dat one dey very high.
In fact, any cannabis wey get thc more dan 1% sef fit cause pesin to get mild effect.
Pipo dey use dis cannabis of 15%-30% thc inside recreational products – wey dey make pipo high well well.
Di narcotics control commission say dem go continue to check and arrest pipo wey dey traffic drugs wey include recreational cannabis.
Dem dey collaborate wit di police to destroy some of dis products wey dem dey scata illegal farms for parts of di kontri.

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/AFP VIA GETTY IMAGES
Wetin dem fit use industrial cannabis for?
Dem fit use di industrial cannabis for many tins.
Apart from say dem fit use am for cosmetic and hair-growth products, dis type of cannabis dey very good for oda tins like plastic.
Dem fit use am for paper, rope, paint and biofuel.
For di textile industry, dem also fit use dis kind cannabis to make fabric sake of dem get durable fibre.
Dis type of cannabis also dey good for pharmaceutical products and oda medicines.
Research don show say global industrial cannabis market dey grow every year.
For 2024/25 , di value of di cannabis market bin dey between $6.2b and $11.42b, according to global industrial hemp market research analysis by Fortune Business insight group.
Di market dey expected to grow even more and reach $72.5b by 2033.
If Ghana begin to grow dis hemp and use dem for di many tins wey dem fit use am for, e go create more value for di economy according to experts.














