'Dem traffic me to go work for igbo farm sake of my family debt'

- Author, Georgia Poncia
- Role, BBC South East Investigations Team
- Author, Duc Ha
- Role, BBC Vietnamese Service
- Read am in 4 mins
One man from Vietnam say im no sure say im go recover from di smuggle wey dem smuggle am enta UK inside lorry and force am to work for one cannabis - igbo- farm to pay off im family debts.
Nam, no be im real name, na from Ha Tinh.
Im say dem beat am, force am to work for 19 hours each day and e bin no get choice to escape. But im no dey alone.
Nearly one third of di 3,602 Vietnamese migrants wey land UK by small boat last year bin dey identified as potential modern slaves, although dis number fit rise.
Di goment say e dey increase immigration enforcement to tackle di criminal gangs wey dey extort pipo.
Witout authentic pipo and companies to borrow money from, pipo for Vietnam dey usually go to money lenders wey dey charge high interest rates.
Dis money lender dem dey work wit trafficking gangs, wey go force pipo into working against dia will if dem no pay dia debt.
Wen Nam papa bin sick wit lung cancer, im family borrow di equivalent of £186,564 from one money lender.
Gnangs force Nam and im sister to go abroad to work to repay di debt.
Dem carry am go Russia wit fake passport, den transport am through Europe.
For France, Nam say im traffickers force am to enter one refrigerated lorry, threatening to kill am if im disobey.

Nam land UK through Dover and dem force am to clean house for free, before dem send am go di cannabis factory.
Im say im remember say im dey usually tink: "I fit die for dia nobody go know."
Police eventually find Nam, but di experience don leave am wit physical and mental health problems.
"I no sabi wen I go fully recover," im say.

Van, wey we dey protect im idenetity, na anoda victim of trafficking for UK and dem bin also force am to work for cannabis farm.
Im come UK legally as student but wen im visa bin wan end, im family tell am say im no fit come home becos dem borrow money from money lender and im need to work for two years to repay di debt.
"Dem bin threaten to beat me and threaten say my family for Vietnam no go fit live in peace," im tok.
Border Force officials later discover Van as di gang try to smuggle am enta Ireland.
Im say initially, dem bin no believe say im na trafficking victim and dem tell am say dem go deport am back to Vietnam. At first im bin tink say na good news.
"Den I realise say di debt still dey, di gangsters go still come find me for Vietnam and dem go still make my life, and my family life, miserable," im say.
"I bin no want to live at dat point".
Di Salvation Army say risk dey say dem fit to "misidentify, criminalise and deny access" to di support wey potential victims need.
Dem eventually refer Van and Nam into di National Referral Mechanism - one process wey dey find support for pipo wey be victims of modern slavery - and now, charities for UK dey support dem.
'Hidding for plane sight'
One tok tok pesin for Home Office say e get "strong commitment" to tackling modern slavery, and say im dey concerned to hear about Van experience.
Home Office minister Dame Angela Eagle tell BBC South East say goment must "put pressure on dis organised gangs all along dia supply chains right from di very beginning".
Di goment don also expand im social media campaigns for Vietnam warning about "di risks and realities" of irregular migration.
Di Salvation Army say modern slavery dey "hide in plain sight" and want make di public watch out for di signs, like workers wey look like dem dey fear, look jagajaga, resemble kwashiokor or get injuries wey dem no treat.
Oda signs no too dey obvious like make anoda pesin pay for di worker travel, dey speak for dem, pick up and drop dem off from work at unusual times, or di worker no dey sure of dia own address.










