Akpabio deny Natasha sexual harassment allegation – plus wetin happun for Senate ontop dis mata

Natasha Akpoti and Godswill Akpabio

Wia dis foto come from, Natasha Akpoti and Godswill Akpabio/NASSTV

Read am in 5 mins

Di drama for di National Assembly of Nigeria Senator Natasha Uduaghan wey dey represent Kogi Central Senatorial District and di senate president Godswill Akpabio don enta new level.

Matter become more wen senator Natasha accuse di senate president of sexual harassment and e don lead to investigation.

Howeva, Senate president Akpabio don deny say im neva harass any woman bifor and dat im na well-raised man wit daughters.

Wetin start dis gbas-gbos between senate president Akpabio and senator Natasha na wen she discover say dem don change her seating for di Senate chamber without her knowledge.

On Wednesday wen di plenary resume, new drama start again as senator Natasha submit petition for di floor of di Senate.

Na for di same floor of di house, Akpabio deny di sexual allegations wey dey hang around im neck bifor.

Senate president Akpabio say di matter dey court but allegations no be true as im neva harass any woman at any time and not even senator Natasha wey dey accuse am.

"While I dey aware say di matters dey court, I wan state clearly say at no time did I ever attempt any sexual harassment on di said distinguished senator Akpoti-Uduaghan or any oda woman."

"Dem train me and my siblings very well. Na my late single mother train us. She die for year 2000, through veri difficult time and I diafore get highest regards for women."

Di senate president add say im get four beautiful daughters and "at no time I go ever haraas any woman, and I neva do am."

E further plead wit Nigerians, especially di media say make dem wait for di court decisions and make dem no jump into conclusions yet.

Natasha submit petition on sexual harassment

Senator Natasha finally submit her petition to di senate house, so dem go fit chook eyes into di matter.

She say di petition include abuse of power by di senate president Akpabio and say e no allow her do her legislative functions well.

"Di petition dey for my name against di president of di Senate, Godswill Akpabio on sexual harassment, abuse of power, and malicious obstruction of my legislative functions."

Senator Natasha add say she dey ready for submit her petition against di senate president afta all di allegations wey she don make for national Tv.

"You fit recall on Friday say for TV I make some statements, and I ready to put dis statements for formal petition against di president of di senate."

For di senate house, Natasha, dressed in butter-coloured outfit wit a white scarf wey she hang across her head, she waka go submit di petition wit a bow.

Na from dia di Senate president Akpabio wey also be di accused give order say make dem transfer di petition go committee wey go handle am.

"Dis petition is hereby referred to di Committee on code of conduct, ethics and public petitions to revert to di senate as soon as practicable," Akpabio tok afta Natasha submit di petition.

Meanwhile, for di floor of di Senate di president say make she no tok anytin on di sexual allegation matter but Senator Natasha no gree as she quote Order 10 wey give her di privileges to comment on di matter.

'Dis petition no fit stand' - Drama kontinu

Anoda stage of drama happun for di Senate house afta Senator submit her petition.

Rememba say di accused Senate president Akpabio bin refer di petition to di Ethics committee to treat am, but tins take a new turn.

Di Senate members debate ontop di petition wey Natasha submit wia dem point out to say no go accept dat kain petition.

Wen Senate Leader Senator Opeyemi Bamidele wey dey represent Ekiti Central Senatorial District bin tok, e say di petition no fit stand.

E give reason say di Senate rules no allow make any Senator drop petition wey dem sign by diasef and Senate no suppose accept and refer Senator Natasha petition to Ethics Committee.

"We dey guided by di rules of dis Senate Section 40. No senator shall personally sign a petition to be laid bifor di senate. Di Senate no do well to refer am to Ethics committee."

"Mr Senate president you dey emotional becos say you no wan make e belike say you dey stop di allegations, na why you refer am.

Senator Bamidele say di petition no fit stand wit claims say di matter dey bifor court and e dey violate di Senate rules.

"E no dey competent to stand bifor di Senate becos e dey signed by Senator Natasha. We no fit rewrite our rules for anyone."

"Dis petition no fit stand, becos di issue dey court and e dey defective and in violation of section 20 of our rules. No way wey we go accept dis petition."

Wen Senator Natasha tok to reply, she say di matter of sexual allegations no dey for any court in Nigeria.

"I stand and believe say you refusal to accept and treat my petition bifor di Senate committee on Ethics, dis matter no dey subjudice, e no dey bifor di court."

"Di case bifor di court na di one on cyberbullying wey your special assistant make say my decent dress dey transparent and say I waka seductively and naked to di chambers, na di case wey dey court be dat."

Senator Natasha say make di Senate accept and refer her case to di Ethics Committee to treat.

"Di allegations wey involved you on making sexual harassment moves, abuse of power no dey bifor any court for Nigeria."

"I go appreciate if you accept my petition and forward to Ethics and Privileges committee."

Howeva, Senate president Akpabio ansa say di reason why e first accept di petition na to make pipo wey no understand di Senate rule no go think say dem dey shut Senator Natasha up.

"Evribodi go get chance to speak but no be for di matter. I take dat petition becos I no want di pipo wey no understand our rule for di Senate to think say I dey deliberately silence her becos I dey involved."