'I no dey fear you' - wetin cause kasala between Akpabio and Natasha for Senate

Wia dis foto come from, Natasha Akpoti-Uduaghan/Instagram
Kasala happun for di National Assembly for Nigeria on Thursday between di Speaker, Godswill Akpabio and Senator, Natasha Uduaghan wey dey represent Kogi Central Senatorial District.
Di Senate President Godswill Akpabio give order to di Sergeant-at-Arms to carry Senator Natasha Uduaghan comot from di chamber.
According to local media, AIT di kasala start from wen di Chief Whip of di Senate, Mohammed Monguno, tell di Senate say senator Natasha no gree relocate to di new seat wey dem give her.
Di Chief whip add say di reason why dem give her di new seat na to close di gaps wey di two pipo wey defect from di opposition senators create as dem join di ruling All Progressives Congress (APC) from minority party.
Wetin really happun
Di Chief Whip Munguno make reference to Order 24, wia im point out im authority as Chief Whip, im also refer to Order 6, wey give am and di senate President power to give senators new seats any time.
Im point out say, na from only dia seats senators fit tok from, as im dey try to use Akpabio authority to no allow anybody to tok from seat wey no be dia own.
Senator Natasha no gree o, she stand from her original seat, as she try to invoke Order 10, she argue say dem don violate her privileges.
E no go well as Speaker, Akpabio rule her out of order, im say dem no go fit recognise her sake of say she dey tok from seat wey no be her own.
According to AIT, Senator Natasha wey dem describe as 'visibly frustrated' accuse Akpabio say im dey deliberately silence her voice and also deny her di opportunity to contribute to motions.
Natasha match leg for ground as she tok say she no go gree make dem push her go corner.
She add say di worst tin wey di former govnor of Akwa-Ibom state goment fit do na to suspend her.
Natasha tok say even though dem suspend her, she go kontinu to serving her pipo for Kogi Central and di women of Nigeria.
Natasha sama accuse for Akpabio head say im dey "discriminate against her, malign, and dehumanize her."
"I no dey fear you," she tell Akpabio. "Do anytin wey you like, but I no go comot from dis seat. Una no go silence my voice."
Some senators start to calm di female senator.
Evritin comeback to normal afta di kasala wey drag well-well, Natasha later stop to protest, and plenary kontinu normally.
Even wit di order wey Akpabio give, wen di Sergeant-at-Arms bin try to approach Natasha, fellow senators including her neighbour Senator Austin Akobundu no gree make dem remove her by force.
Oda lawmakers also chook mouth beg Akpabio to calm down.
Dis no be di first time argument dey happun inside di chamber betwen senators and Senate President, Godswill Akpabio.
For July, 2024, di Nigerian Senate President publicly apologise to Senator Natasha Akpoti-Uduaghan afta e make some kain comments wey see am come under criticism by some Nigerians.
For one video wey go viral on social media on 19 July, 2024 during plenary session, Senate President Godswill Akpabio bin tell Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey dey represent Kogi Central say make she no tok wen dem neva tell her to tok, say "di Senate no be nightclub."
Akpabio recently make Senator Ireti Kingibe, wey di represent di Federal Capital Territory para as she waka comot from di chambers sake of accuse say dem dey try to silence her.
Nigerians for social media dey also para for di Senate president sake of accuse say im no sabi tok and address women properly.









