Davido para as three die for Osun local government crisis

Canva collage of Osun state govnor Ademola Adeleke and di Minister of Marine and Blue Economy Adegboyega Oyetola

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke/X, Adegboyega Oyetola/X

    • Author, Gift Andrew
    • Role, Reporter, BBC News Pidgin
  • Read am in 7 mins

Osun state Govnor Ademola Adeleke don accuse di Nigeria Minister for marine and blue economy Gboyega Oyetola say e dey plan to cause kasala for di state on Monday.

Di govnor say Oyetola wey be immediate past govnor of di state dey plan to use security agencies to come enforce one so called court order wey reverse di sack of local government chairmen for di state.

E allege say "di former govnor dey connive wit di state commissioner of police, di state director of DSS and di commandant of di NSCDC plus odas to destabilize di state".

Di govnor tok for press conference wey e hold on Sunday for di state capital.

According to di govnor, di court order wey dem wan come effect no dey exist, but dem wan use am cause kasala and destabilize di state.

"I, however, regret to inform Mr. President and di public say Mr Gboyega Oyetola don conclude arrangement to cause mayhem for Osun State starting from Monday" na so di govnor tok.

E add say di former govnor dey give illegal order to security operatives to enforce 'illegality' sake of say im be di president nephew.

"I chose to alert di nation before dem go kill my people or maim dem". E tok.

E call on di president to instruct di security forces for di state make dem no obey di directives of di former govnor, say di court order no reinstate di former LGA chairmen.

E request di president to use di office of di National Security Adviser NSA to verify di court judgement.

Three die Osun local goment kasala

Two members of di Peoples Democaratic Party (PDP) die for Boripe local goment area, while chiarman of All progressive congress (APC) for Ayedire local goment die on Monday for Osun state ova di ruling of di federal high Court wey sack councillors and chairmen for Osun local goment

Adeyemi Fatai, one local goment chairman for Osun state tell BBC Yoruba say court don ask dem make dem return back into office.

E tok say na di election wey dem conduct for 2022 bring dem into power but govnor Ademola Adeleke wen im enta office stop dem.

Adeyemi tok say im don return to di office and im work don start.

Ayo Toyosi, di chairman of Ayedaade, tok say any any local goment worker wey refuse to return for office go lose im job, becos im too don return to office afta Supreme court judgement.

Osun Police command tok say dem dey try restore peace amidst di ongoing kasala for di state.

Tok-tok pesin for di command, Yemisi Opalola say make evribody calm down and cooperate wit security officials.

She neva make any comment di death of pipo wey die during di kasala.

Wetin dey di court judgement wey dey cause di kasala?

Govnor Ademola Adeleke

Wia dis foto come from, GOV ADEMOLA ADELEKE/ X

Wetin we call dis foto, Govnor Ademola Adeleke

Tori be say after di former Govnor Gboyega Oyetola lose im election to secure second tenure for July 2022, e hold local government, LGA, elections wey APC sweep all di LGA positions for October 2022.

Di People's Democratic Party, PDP and di Action People's Party, APP carry di matter go two different courts and secure judgements wey sack di APC led LGA chairmen for November 2022.

Dis na before dem swear in di incumbent govnor Ademola Adeleke for 28 November 2025.

Since den, APC and di sacked chairmen carry di matter go Appeal court to try to reclaim dia mandate.

On February 10th 2025, one of di appeal courts strike out di judgement wey di PDP bin don secure, but di second judgement wey di APP secure still dey subsisting according to govnor Adeleke.

Adeleke claim say di PDP judgement wey appeal court strike out no still reinstate di sacked LGA chairmen, rather na only striking off e do.

E advise di APC to go secure judgement for di matter wey dem appeal against di judgement wey APP bin don secure.

All dis dey happen as Osun state dey plan to go vote on 22 February 2025 to elect new chairmen and councillors for di LGAs wey dey di state.

But APC wan reinstate dia own sacked chairmen ahead of di forthcoming polls.

Afrobeats star, David Adeleke alias Davido also chook mouth inside di kasala for di state.

Di Grammys nominee call out di Osun State Police Commissioner, Mohammed Umar Abba say make e "respect di rule of law".

Davido promise to dey post photo of di police Commissioner evriday until e do wetin di musician say na di right tin.

APC response

Meanwhile, tori pipo Punch report say di former Govnor Gboyega Oyetola say di tori wey dey fly around no be true say im wan come destabilize di state. E cite im 15 years waka for public service.

For di report, Mr Oyetola advise di incumbent govnor to leave cheap blackmail and rather obey di court judgement and provide security for di LGA chairmen wey court don reinstate.

Di All Progressive Congress, APC, for di state on dia own part say dem don dey follow due legislative process to follow di matter, and now wey court don give judgement, di govnor suppose obey am.

APC state chairman Tajudeen Lawal on Sunday criticize di govnor say im allegedly mislead di pipo ontop di matter of di court judgement wey drop on di 10th of February 2025.

APC argument be say di matter wey dey ground na di case wey PDP carry go court and win judgement wey remove di LGA chairmen, dem say now wey di appeal court don strike dat initial judgement out, di matter go now go back as e be for day one, wey mean say di Chairmen go resume dia work as no court order dey hold dem down.

Ontop di second case APP carry go court, APC say wetin di govnor dey parade na one page ruling wey carry clause 'appeal dismissed for want of prosecution'.

Dem say reason no dey for any local goment election to hold since appeal court ruling imply say vacancy no dey for di LGA secretariats.

You no fit return to office PDP tell Osun chairmen

People Democratic Party don react say di Osun State local goment chairmen and councilors wey dem comot from office no go fit return back into dia offices, as di court don seal dia fate.

PDP tok say afta di pipo of Osun State no gree vote Oyetola as govnor in 2022, e alledgely conduct magomago election to install APC members for di ocal goment witout following di state laws.

Debo Ologunagba tok-tok pesin of PDP say make APC no allow president Bola Tinubu interfere for dis matta becos di constitution make states goments independent of any control from di federal goment.

Di tok-tok pesin ask APC make dem get ready for di coming election from Osun State Independent Electoral Commission (OSSIEC) "instead of make dem instigate violence and killings in di state."

PDP condem di ongoing violence for Osun state and call on di Inspector General of Police to hold APC leaders for Osun State responsible and bring dem to book for di death and killings

"PDP call on di pipo of Osun State to remain calm, law-abiding and get ready for di local goment election."

NLC declare strike for Osun state

As di matter dey shele, Labour Union di Nigeria Labour Congress NLC don declare strike for di state sake of di tension wey dey rise sake of di plan to bring back sacked LGA chairman.

For memo wey di state NLC chairman comrade Christopher Arapasopo sign, e say na sake of di growing tension and safety of dia workers dem declare di strike.

Di memo direct all dia members to stay away from LGA offices state-wide sake of di security situation.

"NLC na apolitical group, but we no fit allow our members to operate wia dia security no dey guaranteed. Make evri LGA staff withdraw dia services wit effect from Monday 17 February 2025" na so di memo read.

Dia sister body, di National Union of Local Government Employees, NULGE Chairman Comrade Nathaniel Ogungbangbe say dem dey follow same route wit di NLC.