Adeleke wins: Supreme Court confam Ademola Adeleke as Govnor of Osun state

Osun Govnor-elect

Wia dis foto come from, Adeleke/Instagram

Supreme Court don confam Ademola Adeleke victory as Osun state govnor.

Di top court wey rule in favour of Adeleke of di Peoples Democratic Party, PDP dismiss di Appeal by Oyetola for lack of merit.

Di five man panel of Judges wey unanimously agree on di lead judgement wey Justice Emmanuel Agim prepare and read, dismiss di Appeal wey Gboyega Oyetola bring come for for lack of merit.

Some of di issues wey dem torchlight na over voting.

Concerning di mata of over voting, court rule say di appellant dem no prove beyond doubt say over voting dey, sake of say dem no provide di voters register and di number of accredited Voters from di BVAS wey be di authentic means to know di exact number of pipo wey vote according to di Electoral Act 2022.

Di judges say di appellant rely only on witness and one independent analyst.

"Voters register still dey relevant to show di number of pipo wry register for di 7744 polling units.To show di accredited number of voters for di election BVAS record shall prevail"

"Di court no go fit admit di opinion of one pesin on wetin dey inside document wey dem present before di court as evidence of over voting. Di expert analysis report na inadmissible evidence" Justice Emmanuel Agim tok.

On di Education of Ademola Adeleke, court say di appellant no also prove beyond doubt say im forge documents.

Court say so far as di schools no tok say di documents im present na fake, dem no get any tin to prove.

Court also para for di lower court say di mata of im certificate don dey settled since 2019.

Oyetola and Adeleke

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Supreme Court go deliver judgement on di Osun state govnorship election on Tuesday

Gboyeya Oyetola and im party, di All Progressives Congress (APC) bin challenge di judgement of di Court of Appeal for Abuja, wey uphold Adeleke as di elected govnor of Osun State for March 2023.

Dem bin want make di apex court set aside di judgement wey cancel di judgement of Osun State Election Petition Tribunal, wey return Oyetola as di winner of di November July 16, 2022 govnorship election.

Di three man panel of Judges wey Mohammed Shuaibu lead overrule di decision of di Election petition Tribunal wey bin sack Adeleke as di winner.

Di Court of Appeal bin hold say di tribunal dey wrong to reach conclusion on over voting on oral witnesses as dem consider information wey dey di BVAS machine and voters register.

Court say di voters register na di foundation of any election and di voters register also dey central on di 2022 election.

Di Justice Tertsea Kume led tribunal bin declare say na di former govnor be di winner of di election.

Afta dem establish over voting, di chairman of di panel hold for im judgement say dem conduct di election wit 'substantial noncompliance' wit di provision of di law.

For 17 July, 2022, di Independent National Electoral Commission bin announce Adeleke as di winner of di election afta e poll 403,371 votes to beat im closest rival Oyetola wey poll 375,027 votes.

See profile of di top candidates (Click di drop-down near di candidate name to read more about am)

Candidates for Osun Governorship election

  • Work: Govnor, Finance expert
  • Age: 68 years-old
  • Adegboyega Oyetola na di current govnor of Osun state.
  • Im come from Iragbiji, Boripe Local goment area.
  • E get degree in insurance and masters in business administration, di two na from di University of Lagos.
  • Before e become govnor for 2018, e work as Chief of Staff to Rauf Aregbesola, di pesin wey e take over from.
  • Work: Businessman
  • Age: 62
  • For 2021, e get Bachelor degree in criminal justice for Atlanta Metropolitan State College, US.
  • Im bin contest di 2017 Osun West senatorial by-election afta di death of im brother, Isiaka Adeleke.
  • E also contest and lost di 2018 gubernatorial election form Osun state.
  • Im na from Ede.
  • Work: Architect
  • Age: 58 years old
  • Dem born am for Osogbo for 1964
  • E get im bachelor and master degree for Architecture from Obafemi Awolowo University (OAU), Ile-Ife.
  • E later get two oda masters degree for business administration and geographical information systems from University of Ilorin and University of Ibadan.
  • Im bin serve as di deputy chairman of di Social Democratic Party (SDP).
  • Work: Businessman
  • Age: 59 years old
  • Dem born Akin Ogunbiyi for Ile-Ogbo, Osun State.
  • E graduate wit degree in agricultural economics from Obafemi Awolowo University and get master in business administration from University of Navarra, Barcelona, Spain.
  • Im na associate of di Chartered Insurance Institute, London.
  • E serve on di board of di Infrastructure Bank Plc and Mutual Benefits Assurance Plc, among oda companies.
  • Work: Engineer
  • Age: 62
  • Yusuf Sulaimon Lasun come from Ilobu, Irepodun Local goment area of Osun State.
  • E get bachelor and master degrees in mechanical engineering from University of Ibadan, Ibadan and Obafemi Awolowo University.
  • Im na former toktok pesin of Alliance for Democracy before and during di administration of Chief Bisi Akande. Dem later appoint am as chairman of Osun State Capital Territory Development Authority OSCTDA for 2004.
  • Lasun na two-term member of di House of Representatives, e serve as deputy speaker from 2015 to 2019.