Who be Eke Hit, di Okija Shrine native doctor wey dem arrest for Anambra State?

Ekene Igboekweze

Wia dis foto come from, Eke Hit/Facebook

Read am in 4 mins

Security operatives for Anambra State, southeast Nigeria, don arrest one ogbonge traditional priest, Ekene Igboekweze, popularly known as Eke Hit.

Di arrest of dis native doctor dey based on one new law wey di state Govnor Chukwuma Soludo bin sign for January dis year to tackle increasing insecurity.

Dis new law wey di name na 'Anambra State Homeland Security Law 2025' also get provisions to stop wetin di goment describe as di increase of fake traditional priests and priestesses wey dem say na im dey behind rising insecurity for di region.

Videos of wen plenty security pipo go arrest EKe Hit for im house for Okija community don go viral on social media.

Di native doctor dey popular on social media wey im dey use to spread im work, including claims say e fit do money rituals for pipo.

E also claim say e fit make fraudsters successful for dia work.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

One of im pages on Facebook get more dan 42,000 followers.

Dis arrest dey come only few days afta authorities bin arrest anoda native doctor for di same Anambra State wey im name na Chidozie Nwangwu popularly known as Akwa okuko tiwara aki.

Who be Eke Hit?

Eke Hit

Wia dis foto come from, Anambra Broadcasting Service

Im real names na Ekene Igboekweze, and e hail from Umuofo Okija, a rural community for Ihiala local goment area of Anambra State.

For one Interview, e tok say di name 'Eke Hit' come from one customer who im bin work for and afta di work dey successful, di man nickname am 'Eke Hit' - Eke from im first name and 'Hit' to show say e dey always hit im target wit im medicine.

Eke Hit tok say e inherit di practice of native doctor from im father Nwokocha Igboekweze. According to am, im mama born 12 children but na only im dey alive.

E bin dey go Catholic church and bin dey for Mass Servers, bifor e later enta Watchman. E bin do travel to Ghana to do business but later come back as e claim say na di spirit of im father carry am come back.

Di man dey always boast say "if I do medicine for you and e no work afta four days I go refund your money".

Even though im na native doctor, Eke Hit tok say e also believe in God and im dey go church once evri year.

Anambra State Homeland Security Law 2025

Di rising insecurity for di south eastern region dey directly connected wit di rise of fake traditional practices for di region, according to Anambra State govnor Chukwuma Soludo.

According to di govnor, for all di kidnappers camp wey security operatives don burst for di state, one common tin wey dem don notice na say native shrine dey always dey dia.

Na becos of dis, di Anambra State Assembly bin come up wit di Homeland Security Bill wey Soludo sign into law for di beginning of di year.

Di law na primarily to establish a security outfit for di state called Agunechemba. However section 18 of di law tok about decriminalisation of money rituals.

Di section say: "Any pesin wey administer powers or charm on any oda pesin for di purpose of commission of any offence or for di purpose of accumulation of wealth by supernatural means other dan by any known lawful means of livelihood commit offence and e dey liable on conviction to imprisonment for a term of six years wit option of fine of 20 million naira or both".

Di law also tok say na offence for anybodi to claim say e get supernatural powers, and anybodi wey dey arrested for di offence gatz prove say e get di powers true-true or im go dey liable to conviction of six years imprisonment or fine of 20 million naira or both.