State creation: Full list of 31 new states wey House of Reps propose

Nigeria Coat of arms

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Di House of Representatives Committee on Constitution Review don make proposal make goment create new states for di kontri.

Na on Thursday dem make di proposal for di creation of new states wen dem read di letter during plenary session. Na Deputy Speaker, Benjamin Kalu, wey preside ova di session.

Chairman of di committee, Benjamin Kalu propose say make dem create six new states for North Central, four for North East, five for North West, five for South East, four for South-South and seven for South West.

If di National Assembly approve dis proposal, Nigeria go get 67 wey don big pass di 50 states wey America get.

Di letter state say "Dis na to inform members say di House of Representatives Committee on di Review of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, 1999 (as altered), don receive legislative proposals for di creation of states and local goments for di following order:

See di breakdown of states hia:

NORTH-CENTRAL

BENUE ALA STATE from Benue State.

OKUN STATE from Kogi State

OKURA STATE from Kogi State

CONFLUENCE STATE from Kogi State

APA-AGBA STATE from Benue South Senatorial District

APA STATE from Benue State.

A 37th state, wey dem go name FEDERAL CAPITAL TERRITORY, ABUJA

NORTH-EAST

AMANA STATE from Adamawa State.

KATAGUM STATE from Bauchi State.

SAVANNAH STATE from Borno State.

MURI STATE from Taraba State.

NORTH-WEST

NEW KADUNA STATE and GURARA STATE from Kaduna State.

TIGA STATE from Kano State.

KAINJI STATE from Kebbi State.

GHARI STATE from Kano State

SOUTH-EAST

ETITI STATE go be di sixth state for di South East geopolitical zone.

ADADA STATE from Enugu State.

URASHI STATE from South East geopolitical zone.

ORLU STATE from di South Eastern Region of Nigeria.

ABA STATE from the South Eastern Region of Nigeria.

SOUTH-SOUTH

OGOJA STATE from Cross River State.

WARRI STATE from Delta State.

BORI STATE from Rivers State.

OBOLO STATE from Rivers and Akwa Ibom States.

SOUTH-WEST

TORU-EBE STATE from Delta, Edo, and Ondo States.

IBADAN STATE from Oyo State.

LAGOON STATE from Lagos State.

IJEBU STATE from Ogun State.

OKE-OGUN from Ogun State

IFE-IJESHA from Oyo, and Osun states.