How man cut off im wife two hands for Enugu despite several separation and reconciliations

Chinonso carri bandage for hand ontop hospital bed
Read am in 3 mins

"My husband raise di matchet to cut off my head, as I put my hand to defend mysef, e cut am off".

Dat na tori of Chinonso Echege a wife and mother. Di husband dey police custody unto say e allegedly cut off im wife hand.

Di incident happen for Ibeagwa, Nsukka for Enugu state, Southern Nigeria.

"E get wen my husband beat me, I still be nursing mother, I carry my pikin for hand run go my papa house, I stay dia for two years", Chinonso tell BBC visit wey visits am for hospital.

"My husband burn all my tins including cloths wey I dey use sleep", she allege.

She add say afta sometime di man come dia house, kneel down beg am for forgiveness, say na di devil cause am. Say im don become better pesin and e no go do such tins again.

"My pipo tell am wetin im go do, im do evritin. My pipo tell me to go back to am. Na for September 2024 I return to im house".

E begin beat me again

Chinonso for hospital

Chinonso say "Im begin do sametins again immediately, yam wey we plant, e carry all of dem go sell. E start to dey beat me again".

"Im no dey gree me answer my phone calls, e break my first phone, e comot my sim card break am into pieces".

Chinonso say she go buy anoda android phone keep for her village, di man tell say if im see am, im go kill me cut off her hand.

"Na so I run go my inlaw house. Wen I come back to go prepare for church, e hold me, use knife cut off my hands".

"Im begin wan use di knife cut off my head, I use my hand defend am, e cut off my hand".

She say she run off go relative house, dem see am, begin raise alarm make pipo come help am.

"My husband run enter bush go hide, village pipo begin search for am, catch am and hand am over to police pipo".

Wen our reporter ask am wetin she go do now? She respond say "my hope be say make di doctors do di surgery well so I go dey fine again, so I go go learn how to sew clothes, and stop my cement bag business wey I bin dey do before".

Sunday Echege blurred picture

Wia dis foto come from, POLICE

Meanwhile police don arrest Chinonso Echege husband ontop accuse say e cut off im wife hand.

Police tok tok pesin for Enugu state Daniel Ndukwe say di suspect tell them during investigation say e cut off di woman hand sake of say e suspect say di woman Dey get affair wit oda men.

E say di incident happun for Ibeagwa, Nsukka axis of Enugu state.

Ndukwe confirm say na through di help of di village dem manage catch di suspect and recover di knife wey e allegedly use commit di crime.

Commissioner for police for di state Kanayo Uzoegbu don order for thorough investigation into di matter.

E advise di pipo say make dem dey use peace dey settle dia matter anytime dem get misunderstanding.