Federal Civil Service Commission get 16,000 applications in 24 hours – FCSC tok afta recruitment portal suffer downtime

Wia dis foto come from, Federal Civil Service Commission
Di Federal Civil Service Commission (FCSC) don advise applicants wey wan apply for di commission nationwide recruitment exercise to dey patient wit di online application process.
Dis na as di commission recruitment portal and di commission website dey experience downtime according to BBC Pidgin check.
"504 Gateway Timeout" na di message wey pipo go see if dem log on to di recruitment portal and dem go see DNS error, anytime dey log onto di federal civil service commission website.

Wia dis foto come from, Federal Civil Service Commission
Di Head of Press and Public Relations, Taiwo Hassan wey follow BBC Pidgin tok, say na normal tin for website to hang if high number of pipo dey try log on to am almost di same time.
E say as at Monday wen di portal open, about 16,000 pipo don apply successfully.
Oga Hassan say e dey possible for di website to hang as dis na di first time di commission go dey carry out recruitment exercise online.
"Six weeks na long time for applicants to apply for di vacancies, if you no fit do am today, you fit do am anoda day. Applicants get until 10 March to apply."
However, di ICT department of di commission dey work to restore di portal and ensure say di recruitment application exercise dey smooth for applicants, e add.
"E dey quite normal for high-traffic sites like ours to experience occasional downtimes as we continue to scale and optimize."
Na on Monday, 27 January, di Federal Civil Service Commission announce say dem don open dia portal and don dey receive applications for recruitment into various vacancies for di commission.
Oga Hassan say na only one role candidates dey allowed to apply for, also every level of education dey captured for di exercise.
Dis na di first time di Federal Civil Service Commission go announce online vacancies for di commission.
Di commission also encourage physically challenged individuals to apply.
Di roles wey dey available na for eligible Nigerians irrespective of dia academic qualifications.
Applicants dey required to upload relevant documents wey include:
- Curriculum vitae
- Degree certificates
- Certificates or declarations of age
- Local government identification
- NYSC discharge or exemption certificates
Di FCSC assure Nigerians of a transparent process wey dey aimed at recruiting qualified candidates to serve for di Federal Civil Service.
Nigeria unemployment rate for di second quarter of 2024 bin drop to 4.3%, from di 5.3% e be for di first quarter, according to di Nigeria Bureau of Statistics (NBS).
NBS neva release data for di 3rd quarter and dat of 2025. However, social economic indicators for Nigeria dey project say di unemployment rate for 2025 go be 4.84%.
According to di agency, dem reason say di rate of unemployed pipo for di kontri for 2025 go tanda for 3.90%, employment rate go be 83.17% and total labour force for Nigeria go be 80.58m.









