Wetin you need to know about di Inec revised 2027 election timetable

Inec officials

Wia dis foto come from, Inec/ Facebook

Wetin we call dis foto, Inec Chairman Professor Amupitan
Read am in 3 mins

Election joinbodi for Nigeria di Independent National Electoral Commission (Inec) don revise di 2027 general election dates dem bin release sake of di new Electoral Act wey di President sign into law recently.

Di revised timetable say di presidential and National Assembly elections go now hold on January 16, 2027, while di govnorship and state House of Assembly elections go now hold on February 6, 2026.

Inec bin schedule di presidential and National Assembly election to hold on February 20 while dat of di govnorship and state House of Assembly's suppose hold on March 6, 2026.

For statement Inec tok tok pesin Mohammed Haruna say dem make di changes after dem repeal di 2022 law and enact di Electoral Act 2026 wey introduce changes to di normal timeline for pre-election and oda election activities.

Dem also review timeline for oda 2027 election processes.

Oda items for di revised timeline

According to di revised timetable, political parties go now conduct dia primaries between April 23 and May 30, and resolve all disputes wey fit come up within dat time.

Election campaigns for presidential and National Assembly elections go start for August 19 while campaigns for govnorship and state House of Assembly go begin on September 9.

Like di repealed law, di new act still say all campaigns must end 24 hours before Election Day.

President Bola Tinubu bin sign di new electoral act into law on February 18 after di National Assembly pass di bill.

Some members of di National Assembly and some Nigerians bin oppose bill sake of how di Senate reject di clause wey suppose mandate electoral officers to do electronic transmission of election results.

Members of di House of Representatives bin earlier sign one version of di bill wey mandate election officials to do electronic transmission of election results from di polling units to di Inec Result Viewing Portal (IReV) immediately voting stop, but di senate reject di reject di clause and say make officials transmit results to collation centres but no make am compulsory for dem to do electronic transmission.

Di matter bin cause plenty gbas-gbos for Nigeria and plenti pipo enta street to protest di matter.

Di Senate reconsider dia earlier stand and resolve say electronic transmission dey optional and say make dem use manual transmission for wia internet no dey