How Inec wan take spend dia 873 billion naira budget for 2027 election

NYSC Member wey be Inec ad-hoc staff raise ballot paper up during di 2019 general elections for Nigeria

Wia dis foto come from, LUIS TATO/AFP via Getty Images

Read am in 3 mins

Di Independent National Electoral Commission (Inec) dey propose to spend more dan 873.78 billion naira for di 2027 general election for Nigeria, according to wetin di chairman of di commission, Joash Amupitan, tok for di National Assembly on Thursday.

Dis money na almost three times of di amount wey Inec take organise di last general election for 2023, wey di total moni na 313.48 billion Naira.

As e dey defend di budget bifor lawmakers on Thursday, Amupitan tok say di election budget dey different from di 2026 budget for Inec wey di total na N171 billion naira.

Dis one na di money wey Inec go take run dia operations for di year, including two off-cycle elections for Ekiti and Osun States, including di Area Council elections for di Federal Capital Territory.

Breakdown of di budget

According to tori from local media di breakdown of Inec budget for di 2027 general election na:

  • Operational costs - N379.75 billion
  • Administrative costs - N92.32 billion
  • Technological costs - N209.21 billion - dis one concern di Biometric Voter Accreditation System (Bvas) plus di Inec result viewing portal (Irev) and oda parts of di election wey concer technology
  • Election capital costs - N154.91billion
  • Miscellaneous expenses - N42.61 billion

Also, oga Amupitan tok say dem plan to engage about 450,000 members of di National Youth Service Corps (NYSC) wey go work as ad-hoc staff during di election.

Dis number dey more dan double of di about 200,000 NYSC members wey bin work as ad-hoc Inec staff for di 2023 election, according to di NYSC director general dat time, Brigadier General Yushau Dogara

According to di budget proposal, Inec suppose pay di corps members wey go take part for di 2027 elections 4,500 naira for dia feeding evriday, 5000 naira per day for dia training wey go last for five days, and about 127,000 naira as allowance for dia election work.

Joash Amupitan na di new Inec national chairman

Wia dis foto come from, INECNigeria/X

Wetin we call dis foto, Joash Amupitan na di new Inec national chairman

In comparison to di budget for di 2023 election, Inec spend di following according to di report of di election wey Inec publish for dia website:

  • Operational costs - N159.7 billion
  • Technological cost - N117. 3 billion
  • Administrative costs - N20.4 billion
  • Miscellaneous costs - N7.4 billion

According to di 2023 election report by Inec, di average cost for one person to vote na about N3,801.

Di next general elections for Nigeria dey expected to happen witin late February and early to mid March of 2027.

Inec neva release di exact dates wen di elections go be but according to di Electoral Act, di commission suppose publish notice of election togeda wit di timetable of events "not later dan 360 days bifor di date appointed for a general election".