Wetin happun as Senate confam Prof Joash Amupitan as Inec chairman

Joash Amupitan

Wia dis foto come from, Joseph Ayo Babalola University

Read am in 3 mins

Nigeria Senate don screen and confam Prof Joash Ojo Amupitan as Chairman of di election body for Nigeria - di Independent National Electoral Commission (Inec).

Di Senate confam im appointment afta senators from both di ruling and opposition parties fire am kwesions back to back.

Evritin just happun sharp-sharp afta President Bola Tinubu tell di National Assembly to confam am.

President Bola Tinubu bin announce Prof. Amupitan nomination afta former Inec oga Mahmood Yakubu serve im term finish and im hand over to madam Mbu as place-holder.

"I dey happy to present to di Senate make dem confam di appointment of Professor Joash Amupitan, Senior Advocate of Nigeria, as Chairman of di Independent National Electoral Commission," Presidency tok for statement.

President Tinubu also tok say im make di appointment "in line wit Section 154 (1) of 1999 Constitution (as amended)" and im dey beg lawmakers to give am dia "usual expeditious consideration."

Di National Council of State bin don already endorse Amupitan appointment.

Meanwhile concerns bin dey about how transparent ProfzJoash Amupitan go be as Inec chairman especially as pipo claim say e get relationship wit di ruling All Progressives Congress.

Tori bin dey fly upandan say Prof Amupitan na part of di APC legal team.

Di 58-year-old Professor of Law from Kogi State, North-central Nigeria.

Im first assignment wey go dey bifor di new electoral chairmo go be di Anambra State Off-Cycle govnorship elections wey go hold for 8 November, 2025.

Who be Prof Joash Amupitan

Di new Inec Professor of Law for di University of Jos come from Ayetoro Gbede, Ijumu local govment area for Kogi State.

E specialise for Company Law, Law of Evidence, Corporate Governance and Privatisation Law.

E become Senior Advocate of Nigeria for September 2014.

Dem born am for April 25, 1967.

Afta e complete im primary and secondary education, e attend Kwara State Polytechnic, Ilorin, from 1982 to 1984, and di University of Jos from 1984 to 1987.

Dem call am to di bar for 1988. E earn im LLM for Unijos 1993 and a PhD for 2007.

E do im National Youth Service for Bauchi State Publishing Corporation for Bauchi from 1988 to 1989.

Bifor dis appointment, e bin dey serve as di Deputy Vice-Chancellor (Administration) for di University of Jos, position wey e hold togeda wit anoda one wey be di Pro-Chancellor and Chairman of di Governing Council of Joseph Ayo Babalola University for Osun State.

Among di academic positions e don hold for UNIJOS na:

Chairman of di Committee of Deans and Directors (2012-2014)

Dean of di Faculty of Law (2008-2014)

Head of Public Law (2006-2008)

Outside of di academics, Amupitan don serve on di board of several organizations wey include, board member of Integrated Dairies Limited, di Nigerian Institute of Advanced Legal Studies Governing Council, di Council of Legal Education, Riss Oil Limited, among odas.

Di new electoral body chairmo also na author. Oga Amupitan don author many books on law like Corporate Governance: Models and Principles (2008); Documentary Evidence in Nigeria (2008); Evidence Law: Theory and Practice in Nigeria (2013), Principles of Company Law (2013) plus Introduction to the Law of Trust in Nigeria (2014).

E dey married wit four children.