'Our hand no dey INEC chairman court case' - DSS

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Department of State Services (DSS) don tok say dem no dey court against di Chairman of di Independent National Electoral Commission (INEC), Professor Mahmood Yakubu.
For one brief communique by dia tok-tok pesin Peter Afunanya, di DSS tok say one recent publication wit di headline “Court Stops DSS from Arresting INEC Chairman”, no get di fact right.
Afunanya say dem point out dia disapproval to di Editorial authorities of di Newspaper wey publish di tori and dem promise to address dia concern but dem neva address am.
'Our hand no dey', DSS
Di tok-tok pesin say im communique dey important to guide public understanding and perception and tell dem say di report dey misleading.
“E falsely leave impression say di Service bin go Court against di INEC Chairman.
“Nonetheless, di Service dey aware of di antics of some mischievous elements wey wan start crisis for di kontri, including creating unnecessary controversies around di forthcoming general elections.
“One of dia strategies na to subvert di efforts of di Service in ensuring peaceful coexistence and harmony.
"Anoda na determination to overheat di polity and subtly exploit di judiciary to distract or even undermine not only di Service but oda security and law enforcement agencies from undertaking dia constitutional roles,” di communique partly tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di DSS warn di pipo to stop dia yeye plans.
Dem also advise all critical stakeholders to dey vigilant and resist attempts to use dem to thwart di law.
DSS assure Nigerians and di International Community of dia commitment to di maintenance of law and order, including accomplishment of a free and fair 2023 election.
Who carry Mahmood Yakubu go court?
One Somadina Uzoamaka accuse INEC Chairman Professor Mahmood Yakub say im do false assets declaration.
For one Originating Summons wey Uzoamaka file against di Attorney General of di Federation (AGF) and Yakubu, di claimant want order of mandatory injunction wey go direct and compel di Inec Chairman to step down pending di investigation and consideration of di various allegations against him by di various law enforcement agencies.
Uzoamaka also seek order of court wey go stop Yakubu frm holding or assuming any public office for ten years.
For im response to di allegation, Professor Yakubu give di court several exhibits to show say di sources of money for di purchase of di properties wey Uzoamaka claim say im illegally acquire. E also insist say im assets declaration na valid one.
Delivering judgment, Justice Maryam Hassan of di Federal Capital Territory High Court Garki tok say di declaration of assets by Professor Yakubu dey lawful, valid and e dey in compliance wit di law.
She also tok say di security agencies wey Uzoamaka list no fit investigate am.
Di Court decline to grant any of di 14 prayers of di claimant, and dem declare say dm no fit remove Inec Chairman no fit dey removed sake of “fabricated” allegations of false assets declaration.
Justice Hassan dismiss di claims of di claimant and allow di counter-claim of di defendant.
'Military no go compromise election'

Wia dis foto come from, Getty Images
For 8 December 2022, di Chief of Defence Staff Lucky Irabor say di military go resist pressure to compromise di 2023 general elections.
Di defence chief tok say di military go remain neutral and assist di police to monitor and secure di process.
Irabor tok for di ministerial media briefing wey di presidential communications team for di presidential villa, Abuja arrange.
Di defence chief say di military no dey political and say dem dey take necessary measures to ensure say dem obey President Muhammadu Buhari directive to maintain neutrality.
'Days of election results manipulation don ova'
INEC Chairman Professor Mahmood Yakubu last year September assure Nigerians say days of manipulation of election results don ova for di kontri.
“I fit confidently tok say di days of wanton manipulation of election results for Nigeria don dey ova,” Professor Yakubu tok.
Professor Yakubu give di assurance for Abuja wia im deliver keynote address during di release of di report on di Election Result Analysis Dashboard (ERAD) by Youth Initiative for Advocacy, Growth and Advancement (YIAGA) Africa.
Di INEC oga say di breakthrough come wit new Electoral Act 2022, wey empower di Commission to adopt electronic means for both accreditation and results management.
E tok say di persistence of di commission on electoral issues, particularly for di management of results, dey well-expressed for extant legal framework, administrative procedures and technological innovation wey dem introduce.













