Nigeria presidential election 2027 go hold on February 20 - Inec

Wia dis foto come from, INEC/Facebook
Di Independent National Electoral Commission (Inec) don release di official timetable for 2027 General elections for Nigeria.
Di ogbonge election body say di notice of election mark di start of di electoral process for di 2027 general elections.
Inec Chairman, Prof. Joash Amupitan, na im announce di formal release of di Notice of Election, di Timetable and Schedule of Activities for di 2027 General Elections.
Inec set 20 February, 2027, as di date for di Presidential and National Assembly election.
Dis announcement of di 2027 election timetable dey come for time wen di National Assembly and Nigerians still dey battle one clause wey dey di Electoral Act about electronic transmission of results.
Di commission say "INEC dey closely monitor ongoing amendments to di Electoral Act, 2022, currently bifor di National Assembly."
Inec say while dem go welcome any reform wey come, dem go still act within di law wey exist bifor di amendment come into effect.
"Di timely announcement of di election date allow political parties, civil society organisations, and di electorate to prepare adequately," Prof. Amupitan tok.
Wen Inec chairman dey address political party leaders, civil society organisations, and members of di press for Abuja on Friday, e say di announcement of di notice of election na important milestone for Nigeria democratic journey.
Date for 2027 presidential and govnorship elections
According to di commission:
- While di Presidential and National Assembly Elections go hapun for 20 February, 2027
- Di Governorship and State Houses of Assembly Elections go hapun for 6 March, 2027
- Campaigns for di govnorship and state assembly elections- December 15, 2026 - March 5, 2027
- Voter Registration - April 2026 - January 2027, to allow eligible Nigerians to register or update dia voter information
- Political parties primaries - July 1 - September 30, 2026,
- Submission of candidate list - October 1 - October 31, 2026
- Publication of final list of candidates - November 15, 2026
Di elections go cover di office of di President and Vice President, Governors and Deputy Governors, members of di Senate, members of di House of Representatives, members of di State Houses of Assembly.
Howeva, election no go hapun for states like Anambra, Bayelsa, Edo, Ekiti, Imo, Kogi, Ondo and Osun, sake of say dem be off-cycle elections.
Inec chairman Prof. Amupitan say di election timetable dey in line with di provisions of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, 1999 (as amended) and Section 28(1) of di Electoral Act, 2022, wey tok say di commission gatz publish di notice not later dan 360 days bifor di election date.
Amupitan say na only INEC get di constitutional authority to fix election dates, and make nobodi spread fake news or mislead di pipo.
Wetin to know ahead of di 2027 elections
According to Inec, under di approved timetable, e get some informate wey political parties and Nigerians gatz sabi as di 2027 elections draw near.
- Political party primaries get to hold within di statutory period.
- Submission of nomination forms get to comply strictly wit di designated window.
- Campaigns go commence as provided by law and end 24 hours bifor election day.
Inec Chairman warn say di commission no go waste time to "enforce di compliance wit electoral laws and timelines."
In terms of readiness, Inec say dem don expand di deployment of technology to enhance transparency.
Dem say dem go also update di national register of voters, collabo wit security agencies to ensure peaceful election for 2027.
Meanwhile, earlier for di year, di Supreme Council for Shari'ah in Nigeria (SCSN) call for di removal of di chairman of Inec, Professor Amupitan, ahead of di 2027 general elections as dem describe am as potential threat to di stability of di Nigerian govment.
For interview wit BBC, di president of SCSN, Sheikh Bashir Aliyu Umar, say Nigerian Muslims no go accept any election results under di leadership of Amupitan as Inec chairman.
Sheikh Umar say dem dey take dis step becos of Amupitan previous actions, especially wen e bin write legal brief say Christian genocide dey for Nigeria.
But di Pentecostal Fellowship of Nigeria (PFN) react to di call wey di Supreme Council for Shari'ah in Nigeria make, wey want authorities to remove di chairman of Inec chairman.
For statement wey di national secretary, Bishop David Bakare, sign, di PFN say di demand wey di Supreme Council of Shari'ah make dey unjustified.
For October 2025, di National Council of State, bin approve di appointment of Professor Joash Amupitan (SAN) as di new Chairman of di Independent National Electoral Commission (Inec).
President Bola Tinubu bin present Amupitan name to di Nigerian Senate for screening, and dem confam am on 16 October 2025.









