Why Nigeria IGP Egbetokun 'retirement age' dey cause tok-tok

IGP Kayode Egbetokun

Wia dis foto come from, Nigeria Police

    • Author, Kareemot Salami
    • Reporting from, BBC News, Lagos
  • Read am in 5 mins

Nigeria Police Service Commission (PSC) reach one major decision on Friday wey order di immediate retirement of officers wey dey above 60 and those wey don serve for more dan 35 years.

Di PSC reach di decision afta one extraordinary meeting wey happun around di time wey some pipo dey call say make di kontri oga of police, di Inspector General, retire sake of im age.

For one statement from di police tok-tok pesin Ikechukwu Ani, "di Police Service Commission bin rise from dia first extraordinary meeting wit di approval to immediately retire senior police officers wey don spend more dan 35 years in service and those above 60 years of age".

Di PSC further tok say dem reverse one 2017 decision wey bin approve dia stay.

"Di commission don passionately revisit im decision and don conclude say di decision for im intent and purpose dey against di principle of di merger of service in di Public service and e violate di Public Service Rule No 020908 (i&ii) wey provide for retirement on attainment of 35 years in service or 60 years of age." Di statement tok.

Under di public service rules, officers wey don reach either of those thresholds statutorily dey required to leave di service automatically.

Di statement, further tok say di decision don dey communicated to di Inspector-General of Police, Kayode Egbetokun.

"Di commission, for im 24th plenary meeting of 27th and 28th September 2017, bin approve make di force entrants have dia date of appointment in di force against di date of dia enlistment.

Meanwhile, di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun bin clock 60 years for September 2024. - Di mata don dey form public discourse as some pipo don begin kwesion how e kontinu to dey stay for office.

Why IGP Egbetokun go still dey office till im tenure expire in 2027

Di kwesion wey bin follow for di mind of many Nigerians be say why di Inspector General of Police Kayode Egbetokun still dey office afta im don clock di age of 60?

Di Attorney General of di Federation and one bill wey Nigerian lawmakers bin amend for 2023 answer di kwesion.

Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Lateef Fagbemi, wen e chook mouth for di matter say as Kayode Egbetokun kontinu to stay for office as IGP dey legal and lawful.

E say di appointment of Egbetokun wey bin take effect from 31st day of October, 2023 for don come to an end as e reach 60 years of age on 4th day of September, 2024, but no be so, sake of one amendment wey bin don happun earlier.

"However, before im retirement age, di Police Act dey amended to allow di occupant of di office to remain and complete di original four year term wey dey granted under Section 7 (6) of di Act, notwithstanding di fact say e don attain di age of 60 years.

Dis don, therefore, statutorily extend di tenure of office of Egbetokun to and including 31st day of October, 2027 in order to complete di four year tenure wey dem grant to am."

"To avoid doubt, Egbetokun continuous stay in office dey in line wit di provisions of di Police Act wey dey amended in 2024 wey allow di occupant of di office to enjoy a term of four years effective from di date of im appointment as IGP, in dis case, 31st day of October 2023," Fagbemi tok.

E say di advisory dey necessary sake of di guidance of di general public.

In June 2023, President Bola Tinubu, bin appoint Oga Kayode Egbetokun as Inspector General of Police.

Dis na in line wit di Section 215(1) (a) of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, 1999 (as amended), wey provide as follow:

"There shall be one Inspector General of Police wey, Subject to section 216(2) of dis constitution, shall be appointed by di president on di advice of di Nigerian Police Council from among serving members of di Nigerian Police Force".

Also, according to Section 7 of di Police Act 2020, di pesin wey dey appointed to di office of di IGP shall hold di office for four years.

Di same act also provide say for di tenure of every police officer in Section 18(8) of di act say: "Every police officer shall, on recruitment or appointment, serve in di Nigeria Police Force for 35 years or until e attain di age of 60 years.

How di call for Egebtokun retirement take start

Tok-tok around di number of years wey IGP Egbetokun go spend for office bin don already cause issue in June 2023 wen president Bola Tinubu bin appoint am.

Di National Assembly dat time bin amend one executive order bill wey allow am stay for office pass im retirement.

But di latest one dey come from di convener of di #RevolutionNow protest, Omoyele Sowore wey say Egbetokun na "illegal IGP", sake of im stay for office afta e don reach age 60.

Di Nigeria Police Force den arraign Sowore on charges of cybercrime. E bin show face for front of Justice Musa Liman of di Federal High Court Abuja to defend imsef.

Meanwhile, Sowore bin don honour one invitation wey police Sama am on Monday 27January, 2025 - wia dem bin kwesion am for di Force Criminal Investigation Department.

Now, Sowore dey face 16-count charge of cybercrime.

Count three of di charge na say on 20 December, 2024 Sowore bin post for im social media handle X handle, say Inspector General of Police, Kayode Egbetokun, "di illegal IG of Nigeria Police Force".

Anoda of im post say: "Mediocrity, incompetence, corruption, a country run by characterless people can not make progress".

Police also allege say Sowore for anoda post for im X handle, say, "IGP Kayode Egbetokun go destroy di Nigeria police if we no act now".

Sowore bin plead not guilty to di 16 count charge of alleged cybercrime.