Ghana lawmakers destroy property for parliament during ministerial vetting wahala

Wia dis foto come from, DAILY GRAPHIC/FACEBOOK
Kasala don happun for Ghana parliament among lawmakers during vetting of president John Mahama ministerial nominees, Thursday night wey cause destruction of property.
Conference room tables, microphone, sound equipment and oda tins don spoil as opposition lawmakers on top di vetting committee protest di decision to kontinu to dey vet some ministers late into di night afta 11:00 PM WAT.
Members on top di committee no gree as di vetting of one minister don drag for plenty hours.
Di committee bin tok say dem go vet three nominees but afta dem vet di first two, dem spend five hours on communications minister designate Samuel Nartey George – many pipo tok say na payback time for di opposition parliamentarians.
Dem tok say di minority MPs on top di committee wan make di minister retract and apologize for tins im tok about di chief Justice, di former president Nana Akufo-Addo and im vice president.

Wia dis foto come from, PARLIAMENT OF GHANA/FACEBOOK
But di minister tok say im dey stand by all di tins im tok about di former government say dem dey corrupt wia dem don support illegal mining wia many pipo sabi for di kontri as galamsey.
"I be pesin wey get principles, I neva dey run away from wetin I believe in, na so I dey stand by every tin I tok about di president and oda goment officials," di minister oga Samuel George bin tok.
Afta di long vetting of di communications minister, di committee decide say dem go vet two oda ministers, but di opposition MPs on top di committee no gree.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na so dem begin to cause di confusion for di conference room wey dem scatter di tables, chairs, microphone and oda tins for di room, so say di vetting no go continue.
Leader of di opposition MPs Alexander Afenyo-Markin tok say "di goment lawmakers tink say dem fit to bully us, but we no go gree for tonight, but we go continue di vetting tomorrow wey we go ask di relevant questions, notin go stop us. Di NDC always bin dey intimidate pipo, we no go gree. Di clerk to di committee na partisan clerk."

Wia dis foto come from, DAILY GRAPHIC/FACEBOOK
Many pipo bin accuse di leader of di opposition for parliament Alexander Afenyo Markin say im bin dey spend plenty hours to question some of di nominees, wey be "to settle political scores".
In fact, di day bifor di vetting of di communications minister, oga Afenyo-Markin tok one local network Citi tv say "as a party, we bin decide say we go vote on three of di ministers, one of dem don eat humble pie wey im apologize for di way im criticize di former president Nana Akufo-Addo, na so e remain two."
"We go vote for di approval of dis two, unless dem decide to also eat humble pie if dey appear bifor di committee."

Wia dis foto come from, DAILY GRAPHIC/FACEBOOK
Dis na wetin sabi pipo tok say na politics.
Afta dem di MPs don destroy di tins for di conference room, dem now adjourn di vetting of di rest of di two ministers (health and foreign affairs) to Friday 31 January.
Leader of goment business for di parliament oga Mahama Ayarigah bin tok journalists say di Sakala wey happun na unfortunate.
"As tins dey now, we no fit to continue di vetting sake of dem scatter tins for here – di tables, di sound system and oda logistics."
Im add say "we dey sorry say dis na di scenes we don dey show di world as kontri wia don dey practise democracy well well, dis na unfortunate."
"I dey beg una - all sides say make we continue di vetting on Friday wia we go find anoda room to do am sake of di logistics for dis place don spoil, we no fit to fix dem early, so we go vet di nominees for anoda room."

Wia dis foto come from, CITI FM/CHANNEL ONE TV
Many pipo don fire di MPs ova wetin dem do.
For January 2021, MPs bin enta free-for-all fight during di election of speaker of parliament.
Dat na di first time lawmakers don throw hand for di chamber wia soldiers and police don enta di house to stop dem.
Sabi pipo tok say dat tin wey happun na ogbonge disgrace for di kontri.
Na so pipo use social media fire di MPs wia cause di Thursday night sakala.
"Na say you be MP neva mean say dem no fit to prosecute you for damaging public property. Dis na dishonourable tins," one ogbonge political researcher Mussah Dankwah write on top im social media.
One political science lecturer for di university of Ghana professor Ransford Gyampo to say "Ghanaians bin dey demand say make police arrest and punish every MP wia destroy state property."

Wia dis foto come from, CITI FM/CHANNEL ONE TV














