Gbas-gbos for Ghana afta president unveil im own statue

Wia dis foto come from, Citi Newsroom
- Author, Wycliffe Muia
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
Ghana outgoing President Nana Akufo-Addo dey face backlash on social media afta im unveil statue of imsef during one tour for di kontri Western Region.
Di monument na to honour di development initiatives di president don oversee wen e dey office, di region minister Kwabena Okyere Darko-Mensah tok.
But many Ghanaians don dey laugh ova di installation - outside one hospital in di city of Sekondi - pipo see am as "self glorification".
"Di pipo of di Western Region deserve beta dan dis sef-serving displays," opposition MP Emmanuel Armah Kofi-Buah post for im X page.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Akufo-Addo go comot for office for January afta two terms in power, im dey boast say im don fulfill 80% of im promises to Ghanaians.
Im unveil di monument, wey dem prominently place for di front of Sekondi Effia-Nkwanta Regional Hospital, on Wednesday during im "tank-you tour".
At di ceremony, Darko-Mensah, wey dey ova see di Western Region, highlight several key projects wey dem initiate under di president.
But di statue don cause kasala, as some Ghanaians dey question di importance wen several key projects remain incomplete.
"E go dey admirable if di president allow posterity to recognise and appreciate im work," one X user post.
One section of di public want make dem comot di statue wen di president comot for office.

Wia dis foto come from, Citi Newsroom
But no be evri one dey condemn am, some dey see am as acknowledgement of Akufo-Addo contributions to di development of di kontri.
"E dey deserving of dis exquisite monument. Di greatest president I don ever get. Ghanaians go miss am," one pesin post, adding say Akufo-Addo na di "founder of Ghana free education system".
During im tour, di 80-year-old president don single out im policy to scrap fees for secondary schools as im "most significant legacy".
Im visit don also feed into nationwide campaign by di ruling New Patriotic Party (NPP). Western Region, in di south-west, na one of di 16 regions for di kontri.
Di president urge pipo dia make dem vote for im deputy, Vice-President Mahamudu Bawumia, for next month general election.
E go be di NPP candidate and Akufo-Addo say one vote for am go be di continuation of di party policies and projects.
Bawumia main challenger go be former President John Dramani Mahama, wey dey seek comeback under di opposition National Democratic Congress (NDC).
Di high cost of living na key campaign issue for Ghana, Africa leading producer of gold.










