'I wish to become di best cardiologist for Africa and di world'

Wetin we call dis Video, At only 18 months old, her mama see say she dey curious about many tins.
'I wish to become di best cardiologist for Africa and di world'

At only 18 months old, her mama see say she dey curious about many tins.

“My daughter go dey ask me questions if I no dey feel well, she always wan know, dat be how e start,” Barbara Arthur, mama of five-year-old Adjoa di Lildoc tok.

Adjoa Lildoc dey make waves for social media with her knowledge of medicine and passion at her young age.

She fit name sicknesses and medical conditions as well as tok wetin dey wrong am with pesin based on dia medical symptoms at her age.

Di little girl from Ghana say she wan become one of di best cardiologists for Africa, na why she start early.

“I wan become doctor to save pipo and to know about di human body so say I fit help to find solution if di body get problem,” di five-year-old tok BBC Pidgin.

Story by Komla Adom and Mobolaji Olatunji