'How I graduate wit first class at 19 years old'

Wetin we call dis Video, Some Nigerians bin drag Tolulope Ekundayo wen she announce say she graduate wit first class
'How I graduate wit first class at 19 years old'

Some Nigerians bin drag 19-year-old Tolulope Ekundayo wen she announce on social media say she graduate wit first class from her department.

Most pipo doubt her sake of her age, dem condemn her looks and wetin make dem para pass na wen she ask Grammy-award nominee and one of Nigeria finest artiste, David Adeleke wey pipo sabi as Davido to sponsor her Master’s Degree go abroad.

For interview wit BBC Pidgin, Tolulope clear issues wey surround her age, di sponsorship mata and how she take excel for her academics despite her small age.

Ms Ekundayo na graduate of Accounting from Adeleke University for Osun state, south-west Nigeria. She graduate wit 4.89 CGPA and she receive plenty academic awards as best student for her department multiple times.

Even though she small for stature, and she enta University at a very young age of 15, she say she no allow anybody bully her or take her shine as she aim high, she bin even attempt to run for the school social director but she bin drop di ambition sake of say she sick.

Tolulolpe no be all books without play, she be pesin wey love football, she be footballer and always like to dey socialise. She say for her University dat time, na she dey help dem organise social events.

Producer: Annette Arotiba

Filmed and edited by Idara Monday