‘How I travel round di entire Nigeria with small money’
‘How I travel round di entire Nigeria with small money’
One 27-year-old Nigerian woman, Adenike Oresanya don share her journey of how she travel round all 36 states of Nigeria, including di capital city, Abuja.
Oresanya say her experience don ginger am to use social media to showcase wetin she say na Nigeria diverse culture to di world.
Oresanya say she begin do travel content creation by accident afta dem post her to Ibadan for her compulsory one-year service, far from her usual life for Abuja.
As many pipo believe say traveling dey expensive, she share budget-friendly travel hacks wey she say fit help, she also share some valuable travel tips, her favorite hidden gems in Nigeria, and interesting stories from her adventures.






