'I bin dey help my mama sell pure water for Stadium bifor I become referee'

Wetin we call dis Video,
'I bin dey help my mama sell pure water for Stadium bifor I become referee'

Gbemisola Yusuf bin dey sell soft drinks and pure water for her mama for Agege Stadium wia she later become professional referee.

Di young lady tell BBC News Pidgin say she wan be di first female Nigerian referee wey go officiate for di World Cup.

According to Gbemisola, she bin get inspiration to become referee wen she see some referees for Agege Stadium.

Gbemisola don officiate for Caf African Schools Football Championship for Tanzania.

Produced and filmed by Mobolaji Olatunde