'I venture into BMX riding becos I like adventure'
'I venture into BMX riding becos I like adventure'
Young Nigerian female BMX rider Uchenna Nkeiru Sylvia aka Slybmx say she venture into dis sport sake of say she like adventure.
Uchenna say she dey ginger oda women say anytin man fit do woman also fit do am.
"Girls no dey gree ride bike, dem go say if dem ride dem go break leg. But me I like adventure, na im I say na dis tin wey I go do wey be say I go give oda women so dat dem go tink say anytin wey man do, dem go fit do am," Uchenna tok.
BMX riding na di new wave of excitement wey dey capture di hearts and minds of young Nigerians.
Produced and filmed by Adekola Olawale






