'Why I dey help children go school for Nigeria'

Wetin we call dis Video,
'Why I dey help children go school for Nigeria'

Prayer Nwagboso say wen she bin dey do her one year National Youth Service Corps (NYSC) for Plateau State, north-central Nigeria, say she realise say children for her host community no like to dey go school.

Nwagboso say di children prefer to dey pick dirty for streets.

She tell BBC News Pidgin say di tin pain am and she tell herself say she go ensure say dis children get education.

Nwagboso bin serve for 2018 wen several communities for Plateau State bin experience armed attacks.

"Di truth be say, one pesin no fit change Nigeria, na all of us go gada our hand say dis kontri gatz stand, we go dey help di kontri move forward," Nwagboso tok.

Produced by Ayuba Iliya

Filmed by Adekola Olawale