One year-old Ace Liam journey as Guinness World Record holder for di youngest artist

Wetin we call dis Video, Ace Liam mama wan use dis Guinness world record to promote art for Ghana
One year-old Ace Liam journey as Guinness World Record holder for di youngest artist

Di first time Ace Liam don do any painting, na im dey only six months old.

Im mama wey be artist discover dis one day as she dey do im own painting.

Chantelle Eghan tok BBC News pidgin say she decide to keep Ace Liam busy as she dey try concentrate on her own work dat day.

But dat, na di beginning of dis journey for Ace, wey now be di Guinness world record youngest male artist at one year, nine months old.

“Dat time, I wan keep my son busy so I carry one canvas wey I spread am for floor wey I put Ace Liam on top wit paint”, im mama explain.

Dat na how Chantelle now begin to dey give am paint every time to paint something.

Ace Liam wit dis record, beat three year-old Dante Lamb from America wey be di past record holder for 21 years.

Ace Liam don do ova eighteen paintings since den and nine of di ten artworks im exhibit for di Soundout art exhibition for January don sell.