Medical jet wey carry sick pikin, her mama and odas crash enta neighbourhood for US

Wetin we call dis Video, Watch: Police respond to di fire afta one small plane crash enta Philadelphia
    • Author, Max Matza, Madeline Halpert & Christal Hayes
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

One small medical transport plane don crash enta plenti buildings for north-east Philadelphia, wey burn house and motor dem and cause injury for ground.

Tok-tok pesin for Temple University Hospital-Jeanes for Philadelphia sat dem treat six pipo wey bin dey injured for ground during di crash, according to IS media report.

Three of those pipo bin dey treated and released but details neva comot about di oda three, according to reports.

Di jet bin dey on medical transport mission on Friday evening and bin dey carry four crew members, pikin patient and di patient escort, according to wetin Jet Air Rescue ambulance bin tok for statement.

Pennsylvania Govnor Josh Shapiro, tok for news conference for di scene of di crash say, "we know say loss go dey", as e call am say na "awful aviation disaster".

Emergency crew rush enta di scene and streets fill wit residents and di burning pieces of di aircraft.

Witnesses describe di scene as chaotic as e full wit pipo wey wound and houses wey burn.

Di pikin for di plane bin dey receive treatment for US for life threatening condition and bin dey go back to Tijuana Mexico na wetin tok-tok pesin for Jet Rescue Air Ambulance, Shai Gold tell local NBC tori pipo.

Di tok-tok pesin say na di mama of di girl, pilot , co-pilot, doctor and paramedic follow her for di plane.

Mr Gold bin tell NBC say na third partner charity na im sponsor di pikin treatment say, "she bin fight well-well to survive and unfortunately dis gbege come happun as she dey travel home."

Di Mexican Consulate for Philadelphia don put notice for X say make any of dia citizens wey dey affected call di hotline.

Dis na as Philadelphia Mayor Cherelle Parker tok say city officials neva know di number of pipo wey don die and as residents to call 911 if dem see di remains of di plane say make dem no touch anytin.

Di crash happun just a few blocks from di Roosevelt Mall wey be shopping centre for very full part of Philadelphia, wey be di fifth biggest city for US.

Di place wia di crash happun dey full of terrace housing and shops.

Videos of di indicident online show as di plane dey crash and how e take start di fire.

Witness describe as objects from di crash spoil motor dem and send di remains enta streets.

One man wey follow CBS, wey be BBC US partner tok say e bin dey drive for di area wen e hear one kain sound and den di loud explosion.

E tok say, "evribodi just start to dey shout".

One witness tell local tori pipo say di explosion just "light up di whole sky".

E tell WPVI-TV say, "I just see plane basically hit building come explode. Di sky light up and I park my car and basically e bad for here oo". E tok say di crash bin feel like earthquake.

23-year-old Ryan Tian tell The Philadelphia Inquirer say e bin dey chop dinner wen e see ogbonge fireball wey turn di sky to orange. E tok say, "I bin tink say sometin bin dey attack us."

Wetin we know about di crash?

Di plane na Learjet 55, e crash around 18:30 local time afta dem comot Northeast Philadelphia Airport, according to di Federal Aviation Administration. E crash less dan four miles (6.4km) from di airport.

Di FAA tok for statement say di plane bin dey go Springfield-Branson National Airport for Missouri. At first, di agency say na two pipo bin dey di plane bifor dem later revise am to six.

According to data for Flight Aware, wey be flight tracking website, di plane bin dey operated by one company wey dem dey call MedJets. Di plane bin just land Philadelphia from Florida, less dan four hours bifor.

Cars wey burn for di street after di plane crash

Wia dis foto come from, Pennsylvania Representative Jared Solomon

Wetin we call dis foto, Burnt cars and and di remains of di plane full street afta di crash

Di FAA and National Transportation Safety Board still dey investigate di mata.

For statement, President Donald Trump say im administration dey "totally engaged".

E say, "so sad to see di plane go down for Philadelphia, Pennsylvania. More innocent souls lost".

Di plane crash dey come two days afta a bigger collision bin happun between one commercial jet and military helicopter for Washington DC wia officials believe say all 67 pipo wey bin dey di two aircrafts die.

Na di deadliest plane crash in di US in ova 20 years.

Smoke dey rise up for di neighbourhood in Philadelphia. Cars dey parked on di street and crowd gather around.

Wia dis foto come from, City of Philadelphia Office of Emergency Management.