How police arrest man wey allegedly kill im 23-year-old girlfriend for Kwara

Wia dis foto come from, SIKIRULAI ANDE
Police for Kwara state southwest Nigeria don confam say dem arrest one 29 years old man wey allegedly kill and pieces di body of one 23-year-old female student of Kwara State College of Education, Ilorin.
Tok tok pesin for di state police, SP Adetoun Ejire-Adeyemi, tell BBC News Pidgin say di name of di victim na Yetunde Lawal, say dem don begin investigation to know wetin really happun wey lead to di murder.
According to di tok-tok pesin, dem first receive alert of missing pesin from di victim papa.
"Our detectives begin follow di mata, dem track di phone of di girl sotey e lead dem to di suspect house and dem arrest am," na so she tok.
Na inside bowl dem find her bodi

Wia dis foto come from, SIKIRULAI ANDE
Tori bin comot on Saturday morning say police don find di bodi of di missing lady.
Local tori pipo Daily Trust report say through police investigation dem arrest di suspect, say im initially deny knowledge of di lady whereabout but during search of im house, e allegedly confess say di lady die of asthma.
According to dem, security personnel find di dismembered bodi of Yetunde inside bowl for di suspect house.
Tori for town be say dem both meet online and begin friend till di suspect invite her over.
Police say di lady bin don dey miss since 10th February. Na four days later dem find her bodi for di suspect house.
Late Yetunde na di first pikin of her family. Her papa and mama still dey alive. She bin dey final year for Kwara State College of Education, Ilorin, bifor di incident happun.
Similar incident happun for October 2024 for Nasarawa state, north-central Nigeria, wen one gospel singer allegedly kill im girlfriend and dismembered her bodi.
Police later arrest am wen di bike man wey carry am raise alarm say fly dey follow di bag wey im carry. Wen dem search di bag, dem see di head of im girlfriend for inside di bag.
Di suspect presently dey detention as im case don go court.









