Friends mourn fresh Nigerian graduate wey boyfriend allegedly behead

Wia dis foto come from, Salome Adaidu/Facebook
Friends on social media dey mourn di death of Salome Adaidu wey her boyfriend allegedly behead for Nasarawa State, north-central Nigeria.
Dem allegedly gbab Timileyin Ajayi wey be gospel singer wit Adaidu head on Sunday 12 January near one church for Orozo.
One video wey go viral on social media show as pipo surround Ajayi wen dem gbab am and begin ask am question about di human head and di lady wey be corps member.
She tok say Adaidu na im girlfriend and add say dem don dey date for about one year.
Police for Nasarawa confam di incident to BBC News Pidgin and add say dem find di remains of di victim wey don dey cut into pieces for im house.
Reacting to di tragic tori, Anibe Treasure Utenwojo wey be Adaidu friend say she bin see di tori for internet and no know say na about her friend until she visit her work place and see say e dey empty.
She say she bin ask Adaidu colleague about am and na di pesin break di news to her.
"Salome Adaidu, your killer no go eva go unpunished and may your gentle soul rest in peace," she write for her Facebook page.
One Nigerian man on Facebook identified as Babyshark001i tok about how she bin meet Adaidu on di social media platform and exchange numbers wit her.
"Now I dey see news about her demise. She don dey allegedly murdered by her boyfriend Ajayi, wey happun to be "gospel singer", Babyshark001i tok.
"Her mama faint from di shock of her death"
Abby Simon wey be Salome Adaidu friend tell BBC News Pidgin say na sad experience for di deceased mama wey just lose her husband seven months ago.
She tok say di deceased mama bin no dey for house wen di incident happun becos she travel for Christmas holiday and wen dem break di news about di death of her pikin to her on Monday night, she bin faint from di shock.
"Her mama travel two weeks ago and na yesterday dem call her say her pikin dey for hospital," she tok.
"Na wen she reach house dem break di news say her pikin don die. She faint and lie for floor, she no fit move body."
Abby tok say Adaidu comot from house on Saturday evening afta she bin clean and arrange di house.
She tok say Adaidu bin go meet her own boyfriend wey dey live for Karu for Abuja but she no reach im house.
She explain say Timileyin mutilate her friend for Orozo and carry di body parts ontop bike to Oke for Nasarawa State and na dia bike man notice say di bag wey im carry dey drip blood.
"She no reach im house, e no even dey aware of wetin happun until all of us know wetin happun. Dem fit don kidnap her inside di bus she enta to go her boyfriend house, wetin we know be say she reach Orozo and na dia Timileyin kill her," Abby tok.
"Dem arrest Timileyin for Oke for Nasarawa, na di bike man wey carry am from Orozo to Oke notice say blood dey drip from im nylon bag and pipo begin question Timileyin wen di bike man call for help."
She say pipo begin beat Timileyin as dem dey question am for Oke wia dem later call police to arrest am.
Abby say wen di deceased sister visit di house for Orozo wia Timileyin allegedly kill Adaidu, di place dey scattered wit blood and her belongings.
"She no get relationship wit am, no family member sabi am from anywia. We be community and we sabi each oda and she no get any relationship wit Timileyin," she tok.
"Nobody deserve to die dis way. Even if she be im girlfriend, she no deserve to die dis way," Abby add.
Police discover di mutilated body pack inside bag nylon
Nasarawa police tok-tok pesin tok-tok pesin Ramhan Nansel say di information wey dem gada be say one commercial motorcyclist pick one Timileyin on di 11 January from Kabba in Kogi state to Karu local goment for Nasarawa.
Di police say di bike man notice say blood dey drop from di passenger bag, e raise alarm and pipo begin gada to beat Timileyin.
"Di mob beat di suspect and pipo call di police to rescue di suspect. We rescue di suspect and discover human head. We carry am go hospital for medical treatment," Nansel tok.
Nansel say dem follow up wit di mata to go search Timileyin house wia dem find di mutilated body of di 24-year-old Salome Enejo Adaidu for inside nylon bag.
"We get search warrant to search im residence wia we find di remains of di victim, Salome Enejo Adaidu, corps member, cut into pieces and pack into nylon," e tok.
Police say dem no dey aware of di relationship wey dey between Timileyin and Adaidu.









