Why Elon Musk dey carry im children go work
- Author, Rachel Looker & Lily Jamali, tech correspondent
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
Elon Musk children don go some kain places wey many no go ever fit see.
From meetings wit foreign leaders to control room of SpaceX launch, Musk pikin dem dey always show as constant sidekicks to dia papa work for tech, business and now, politics.
Dem don show plenty times for di United States capital since President Donald Trump tap di tech billionaire and Tesla co-founder to lead di newly-formed Department of Government Efficiency.
Musk four-year-old, "Lil X", hang for one corner of di Resolute desk for di Oval Office on Wednesday, im bin wear one brown pea coat and shirt wey get collar.
On Thursday, X and two of im siblings exchange gifts wit India Prime Minister Narendra Modi as dia papa dey discuss technology and innovation wit di foreign leader.

Wia dis foto come from, Getty Images
Even bifor im go Washington, e common to see Musk wit im children - for one meeting wit president of Turkey, one memorial service for Auschwitz concentration camp, and one Time magazine ceremony wia dem bin name am di 2021 pesin of di year.
Why Musk dey carry children follow body?
"Di inclusion of di children for many public appearances na politician move or political move wey dey make am look like im dey a bit more personable (and) take human approach to how pipo for public dey take see am," Kurt Braddock, wey be American University professor of public communication, tok.
Still, Braddock tink say di decision to bring Musk kindergarten pikin to Oval Office dey unusual.
X bin look like say im dey bored during di 30-minute press briefing as im bin dey mimick im papa.
Di pikin bin sidon for floor and once, once, im go receive occasional side glance and smile from di leader of di free world.
At one point, e be like im tell someone for di room to "shush" dia mouth.
Oga Braddock say im believe say dia inclusion dey intentional - na distraction wey benefit both Musk and Trump.
"I dey tink am say, e get some kain strategy here trying to draw attention to some tins as dem dey divert attention to oda tins," im tok.
Jon Haber na strategic communication consultant wey don work wit five presidential campaigns and im dey teach for Harvard, im say Musk children making frequent appearances - and creating viral moments - dey beneficial for Trump.
"For Trump, di more chaos, di more im dey flood di zone, di less pipo go actually fit focus on. Chaos dey work for am," Haber tok.
Grimes, Musk ex-girlfriend and di mama of X, bin criticise her son appearance for Oval Office.
"Im no suppose dey for public like dis," she write for one post on X. "I no see dis… but I dey glad say im bin dey polite. Sigh."
For one 2022 Vanity Fair article, she say she no gbadun di idea say her pikin dey spotlight.
"Whatever dey go on wit family stuff, I just feel like children need to stay out of am, and X dey just dey out dia. I mean, I tink e dey really see am as protégé and to bring am to evritin and stuff.… X dey out dia. Na like so im situation just be. But, yeah, I no know."

Musk and im pikin dem
Long bifor politics, Musk dey allow im children follow body.
Ten yeas ago, wen im bin still dey build im profile and dey eager to draw attention to im electric-vehicle maker Tesla, e bin no dey unusual to see dem for events.
As analysts and reporters bin dey wait for di unveiling to begin for one Tesla facility for Silicon Valley for 2015, you go fit see im five children dey run through hallways as dem dey chase afta each oda and shrieking wit laughter.
Even though pipo bin dey forced to wait for hours for attendees, di presence of Musk children create atmosphere wey bin feel relaxed and even joyous.
Na departure from di stiff, far more formal events wey oda companies dey do wia di prospect of seeing executive veri young children go dey odd.

Wia dis foto come from, Getty Images
Musk get 12 children wit three different women.
Im most-recognised son, X Æ A-12?, dem dey call am "Lil X", di same letter wey Musk bin use to re-name Twitter wen im bin buy di social media company.
Musk imsef dey call di four-year-old "emotional support human".
Walter Isaacson, di author of Musk biography, say for di The Diary of a CEO podcast, Musk dey "deeply committed" to im children and dey "almost obsessed by dem".
"Wit im own children, im lovers, im wives, e get di same intensity wey dey baked into evritin wey im dey do," Isaacson tok.
"Im dey like to always get some of im children around am. Im dey always like to get companion, but dat no mean say im like calmness."










